Friday, February 1, 2019

Chai! BBNaija Auditions 2019: See As Man faint, As Slay Queens, Others Dey Climb Fence Make Dem Beat D Long Queue...




From Ali Ina...



Chai! Nothing wey Nigerians no go do because of Fame, exposure and prize of N45m… Haaaw! Even me as I dey talk am sef, the thing dey tempting…. This money don dey worth the kind fight wey don dey happen for Lagos because of the popular reality show wey be Big Brother Nigeria. As people hear about am this year, many youths don rush go several venues around Lagos with the hope say dem go get their own  chance.
For Lagos, for one audition center for Adeniyi Jones, Ikeja, if you see the kind crowd wey bombard the area ehn… hia! Fear go catch you… The crowd been don gather for here since before 6am sef  and the thing don cause one kind standstill for the environment.
But that one small, wetin dey worry me now be say, several youths dey very willing to risk their lives, just because dem wan reach the front of the judges, make dem for fit take their chance for fame. Some people even climb over the fence and the blockade wey dey the event center, wey dem wan use for the audition.
Hmmm this wahala don attract police wey no get choice but to con calm this crowd ooo!
Ontop of the katakata wey dey go on, one man wey also come for the audition get time to faint because of say, him don tire. Na so plenty people gather around the man as dem ma, no know wetin to do.
But even the attempt to calm down the youths wey come for the audition sef no even help matta at all… As e con be like say na every youth for lagos state gather for the venue.
Na wa! Nothing wey we no go see for Naija ooo! Ha!

Sodomy: Man Don Infect 16-yr-old Neighbour Son With HIV




From Ali Ina


Operatives of the Gender Unit, Lagos State Police Command, don arrest one 32-year-old man, Prince Chinecherem, because say him go introduce one teenager to wetin oyibo dey call sodomy… Sodomy na when mature man dey do touch-touch with small boy… Him no con stop there o! Him go infect am with the Human Immune Deficiency Virus, HIV, and this one happen for Ejigbo area of Lagos State.
W hear say Chinecherem, introduce the victim to this kind thing several months ago and them don dey do am together for the back of the small boy Parents, wey no know say dem dey always do am for inside Chinecherem room.

But, their bubble con burst on January 22, when neighbours con see the small boy as him dey take style like thief wey dey hide do bad thing, dey commot from the suspect room, after them don do touch-touch finish. Na so the Curious neighbours con stop the small boy, dey ask am wetin him go do for the suspect room. When him no fit give answer wey go satisfy dem, dem con ask am make him open the plastic bag wey him been hold, but him no gree. After dem force am, dem con discover say na freshly used condoms wey milk full inside.

Na when dem con continue to ask the boy wey we hear say na 16 years old, him con open up tell dem wetin happen for inside the room… Dem don carry the matta go Ejigbo Police Division, before dem con arrest the suspect. From there, dem transfer am go the Gender Unit for further investigation.

Dem con carry The suspect and victim go for medical examination, wey con reveal say the small boy don dey do touch-touch with man, wey oyibo dey call homosexuality tay tay... Further medical test con reveal say, both of them dey HIV positive. Parading the suspect and other notorious criminals for the Command Headquarters, for Ikeja, yesterday, the state Commissioner of Police, Edgal Imohimi describe the incident as unfortunate.

 According to am, “this one confirm wetin I don dey always talk, say make parents and guardians try as much as dem fit to monitor the activities of their children and anybody wey dey under dem to avoid this kind disgrace. “We go Charge The suspect go Sexual and Special Offences Court wey dey here for Ikeja, while the small boy go undergo treatment and rehabilitation.” Na so him talk

Chai! Pastor Why? Ehn! Why?




From Ali Ina


Ha! Pastor Why! Ehn, Pastor Why! Anyway make I no talk too much incase you dey wonder which Pastor I dey talk too like that… Hear am…One Mapo Customary Court For inside Ibadan, on Thursday wey be yesterday don scatter one 18-year old marriage between one Grace Adekunle and Pastor Adeyemi Adekunle because of wetin dem say na abandonment, irresponsibility and impregnating church members. Hia! Again I dey ask, Pastor why! Oh!
Anyway, for her petition, the claimant, wey be school teacher been don tell the court say her husband, wey be pastor, been abandon her, con committ adultery wey mean say him go do touch-touch with him female church followers. Ontop her vex, she talk say:
“Firstly, Adeyemi never show any form of responsibility ontop any of the five children and me since wey him become pastor some years ago.
“Adeyemi no dey even make provision for their feeding or even send them go school.
“One message wey Adeyemi dey always repeat for my ear be say, make I no expect am to send the children go school because him na poor man of God.
“Him also talk say, shey I see am as pastor before I agree to marry am.
“Because of this, none of our children wey dey between 8 and 16 dey any school as we dey talk.
“I don spend everything wey I get ontop the children and I never see any progress since.
“The worst part be say, Adeyemi don dey do touch-touch with female worshippers inside him church and him don even impregnate two of them,” Na so she talk.
The respondent kuma, no con dey for court when them call am make him respond to the allegations.
 Chief Ademola Odunade, wey be President of the court con rule say, e don dey necessary tyo scatter their marriage because love no dey between them again… But him still talk say dem go grant custody of the first four children to Adeyemi while the last one go remain with Grace because of him age, plus him go dey pay monthly allowance of N5,000 and him go dey responsible for the pikin education and other welfare…

"Na me be d present Queen, Face of Arts Nigeria 2018/2019"... Miss Ocheja Umekwuojo Blessing


"Beauty", as we know am,  get different levels. Even sef, e get different sizes and shapes... And this na one great requirement for Beauty Pageants b4 dem go crown person as "Beauty Queen"... Na so, her Beauty + talent + plus + brains + betta waka don make Miss Ocheja U.  Blessing become another Beauty Queen wey don dey make News now, no matta how anybody think am or talk am... But make we leave matta for matthias, follow me as we begin betta tori waka with The Face of Arts Nigeria...

"My full Name na Miss Ocheja Umekwuojo Blessing... My mama carry me for belle sotey she born me on the 14th of June 1997 wey be Saturday..." Chai!  The way wey dis Beauty Queen dey dish out pidgin ehn,  no be here ooo... Make we hush,  she still dey talk. ... "I dey 400level for Kogi state university, Ayingba and na physics I dey do...." Chineke! So physicists dey fine reach like dis... Ha,  c wonders o! "I dey always like to dey hear jams, dey dance and I dey like travel wel-wel..." This one no be lie,  if you see how dis Beauty Queen dey scatter ground ehn, you go know say Kaffy own na play..." (no be me talk am o)
When we ask am wetin be her Philosophy in life, she no waste time to say; "for this life my philosophy be say, make you do wetin go make you happy evrytime because na only one life you get oooo (YOLO).... "Yolo"? No ask me o!  If you see am,  make you ask am because her pidgin dey solid,  no be small thing..."
She still con talk say; "as you see me so ehhn, I like enjoyment die and I like people wey get free mind..." Na so!  This Queen na correct babe,  I no go lie... Ontop her Dislikes she say; " I no like people wey dey selfish and person wey dey carry people for mind...." You sef wey dey read, no carry am for mind o,  if not "OYO" na your case o!

Presently, she con tell us when we ask her wetin be her office name as per Beauty Queen? With her straight smile and correct set of teeth she say; "na me be d present Queen, "Face of Arts Nigeria 2018/2019" E remain small I for forget say na work I dey but sharperly I retrace... Lol!  Make we continue jare... How u take reach where you dey now? She talk say: "Na with the support of my Family and people wey like me, I take reach that level..."
Ontop her Achievements So far, she yarn say; "For my own small way I don try inspire people say them fit achieve goals for this life..." But she no stop there as she still get hope to achieve something with her office...  She say; "I go make sure say I join hands with people and together we go put better smile on the faces of people wey get disabilities...." Shey you see say I no lie when I say dis Queen na correct babe!

For her Final Message to youths, she still no waste time to talk say; "my brothers and sisters abeg make una no allow anybody deceive una say Nigerian youths dey lazy, make una try put una best into wetin una dey do and the sky no go be una limit but una starting point... THANK YOU!!!

OKPE LAWRENCE OKPE: CEO, Black Giant Signatures/Black Giant Movies. Founder - Face of Art Nigeria Beauty Pageant & Giant Strides Awards, Pioneer of Operation Touching Heaven charity project. And very articulate plus professional Compere wey we sabi as MC.


Okpe Lawrence Okpe
CEO Black Giant Signatures
Chai!  Tru-tru ehn,  na d gift of man,  na im dey open road for d man.  Some people story ehn fit make you do u-turn For your own life, to do wetin oyibo dey call,  "self-evaluation..." But dat one go be tori for another day, d koko today na about one Giant wey dey make gigantic small steps as him dey where him dey,  dey mind him business but d thing dey open doors for am wel-wel...  Na so my waka Carri me go meet the CEO, Black Giant Signatures/Black Giant Movies. Founder - Face of Art Nigeria Beauty Pageant & Giant Strides Awards, Pioneer of Operation Touching Heaven charity project. And very articulate plus professional Compere wey we sabi as MC. This young man  na very hospitable, talented, inspiring, motivational and determined Giant wey get plenty things to talk about...  Make we meet am:


"My name na Okpe Lawrence Okpe, born on 20th October...(I no know why people sabi stop for here,  as I try to go front make him call d year, d straight forward Giant just smile,  talk say "make we leave am for there.. ." But him no stop there ooo...
Actor, film maker, producer, Director


"I graduate from Benue State University, Makurdi... My hobbies na Writing, Singing, Drumming..." Omo! I almost talk say this one go be "robe of many colors" in d guise of man ooo...  Lol!  But make we read on...


"Nothing wey person don ever achieve,  wey dey impossible for anybody to achieve..." Sebi I tell una say na motivational and inspirational person,  e no dey hard am to switch... Anyway make we fire on...

 "I like Sincerity, Truth and humility..." "I hate Lies, Pride, Backbiting..." Hmmm, no be small thing o! When we ask am,  how him take reach where him dey,  e no hard am to sharperly talk say na: "Discipline, Consistency, Focus,  Hardwork above all God's grace" No wonder him na d Giant koko-master from where him come from...
BYCA Awards 2018
As this young man dey so,  him Don achieve plenty ooo... "BYCA Awards 2018 - Best Indigenous Actor of the year,  KEA AWARDS - Event Planner of the year, MNE Pageant Coordinator 2015... And other Awards... 


Over 5 movies wey dey produced under the Black Giant Movies production, For Face of Art Nigeria Beauty Pageant, we don  crown over 7 Beauty Queens, Giant Strides Awards don present and celebrate with the award of excellence, with over 50 talented youths under the Black Giant Signatures team wey dey make great moves enta stardom through the opportunities and platforms wey we present to them so dat dem go fit  express their God's given talent. Operation Touching Heaven Charity Project too,  na life changing medium wey we dey use to touch the lives of Internally Displaced Persons(IDPs), The less Privileged, Widows and people wey dey live with disabilities inside Nigeria. I don act over 15  movies starting from INALE wey na Bongos Ikwe produce am. Down to the most recent UNCHURCHED wey na Black Giant Movies produce am. I don direct 5 movies and I don work as Assistant Director for two movies (Wages) Wey na ECWA TV and Tonak Media Consultancy and Entertainment produce am.  And (I Do) wey na African Magic Hausa produce am.  Etc Shuu!  Him finish work here o, with plenti-plenti results to show sef...

"I don dey plan to set up the Black Giant TV for future, where viable contents go dey broadcasted and we go discover plenti-plenti talents dem, we go nurture and send dem enta market...
I also dey plan to use the Operation Touching Heaven Charity Project to touch lives all around the world through the Queens wey we crown under d Face of Art Nigeria Beauty Pageant.
I strongly believe say Inside Year 2025 Giant Strides Awards go be one of the most celebrated accolades for Africa, we go celebrate ideas and we go reward excellence through that platform."


I no sure say we fit ever get enough of this young CEO but hear him final message to youths wey dey like himself...
"To the youths, success dey come through process and e no dey without stress. But make you always do your best, con leave the rest... Make una no do wetin you no go do for inside good state of mind."
With Veteran Actor Clems Ohameze


At One Of The IDP Camps Abuja... 

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land