Tuesday, January 22, 2019

First Lady Don Make Local Government Chairman To Kneel Down After Him Go Dey Shout APC For Inside PDP Rally (Photo)...






From ALI INA...

Wonders no go ever end for this life o! Come see public disgrace for Benue State… One Local Government Chairman wey be Francis Ayagah, been dey kneel down as punishment after him go dey shout APC for inside PDP rally(laughs). We hear say Francis, na him be the Chairman of Gwer West Local Government council and dem been elect am chairman ontop APC platform but him con defect inside the new political realignment for Benue go PDP.

We hear say the Local Government Chairman wey been dey kneel down for public, go make mistake for one rally wey Governor Samuel Ortom wife, Eunice, been organize  for the reelection of her husband inside the local government area. We no know wether na out of ogogoro o, or out of the happiness wey full him belle, na so this man just go dey shout Aaaaaa Peeeee Ceeeee (APC) two times after him climb the podium, na so everywhere just dey quiet as him no get any response from the PDP supporters wey just dey embarrassed say their Chairman dey do this kind blunder... Chai! This one na big political mistake o!

Anyways, we hear say Francis wey be Chairman of the local government area wey the Governor wife come from don appear before the PDP elders make him explain the error as na them quickly summon am to ask am serious heavy questions. Na there we come see am dey kneel down for their front, for wetin our sources no know wether na punishment or him dey beg them…



Shocker: See How Church Member Defraud Him Own Pastor Of N9Million...





From ALI INA...

To fear God these days no be big deal o! Sotay person dey get liver to dupe pastor without fear of wetin God fit do am… hmmm… One man wey dem say, him get liver to dupe him pastor of big money wey run into millions, dem don tell am say, make him pay the money, sake of say, na criminal act him commit…

Hmmm! We hear say, because him dupe him Former Pastor of N9m, the Police on Monday don carry the 39-year-old businessman, wey be Obiora Okosi, go one Gudu Upper Area court, wey dey siddon for Abuja, na so News Agency of Nigeria wey be NAN talk.

The defendant, wey dey live for No. 89 Limka Rd., Nkpor, Anambra State, dey court and dem dey try am ontop two counts of criminal breach of trust and cheating.

The prosecutor, Blessing Igale, been tell the court say, one David Elijah of 3rd Avenue, Gwarimpa, Abuja, na him report the case for Police Force Headquarters, Abuja for December 2018.

Igale been talk say, the defendant convince Elijah, wey be the General Overseer of Grace Prophetic Ministry, Awka, make him buy plot of land wey dey inside FCT-Abuja for N12m.

She tell the court say the complainant been don pay the defendant N9m for the land but all the efforts wey him make to recover the land or to collect am back, no give am result.

The prosecutor con still talk say, instead of to return the money, the defendant con dey threaten the life of the complainant.

The prosecutor say, the offences contravene or go against the provisions for sections 311 and 321 of the Penal Code. But the defendant, come plead not guilty to the charge.

The Judge, Bello Rufai, con grant the defendant bail of N1m, plus including one surety wey get the same amount.

Rufai con shift the case go January 29, for hearing. Na God I dey take beg una ooo, cheating no good, wether the person na pastor or no be pastor. but if you think say na normal thing, no worry, like my colleague dey always say, one dey monkey go go market, e no go come back again…


Lecturer Beat Him Wife To Death Two Weeks After She Welcome Their Pikin For Rivers...



From Deborah Odoekwu...


People dey very heartless o! your own blood ehn? Na wa o tins dey happen o!

One lecturer for College of Health wey dey rivers state, wey im name be Mr Jonathan, don dey accused say im beat im wife wey her name be Ole, sotey she die just two weeks after she just born pikin for am.

Hmmm

The aunty of this woman dem kee so, wey her name be Nkesi Wogu, come carry cry come on top Facebook, come talk say the woman husband wey be Mr Jonathan dey on the run after im bn beat im wife sotey she die for the woman mama front. She talk say her niece wey carry pikin wey be two weeks old bn receive betta beating from her husband sotey she come die, say the man don run commot after e do wetin im do for the front of the girl mama wey see everything wey happen. She come say “bye bye my gentle sister, may your soul rest in peace”


Kai!

The sister of the woman wey die so wey be Constance Wogboroma come still come on top facebook dey cry say her own sister, her own best friend, person wey she dey always gist with don die, say, so the talk wey dem talk yesterday na bye bye be dat! She come dey cry dey talk say she wish say she go fit bring am back at least because of the two weeks pikin wey she leave.

Hmmm!

This one tire me oo

Anyways dem don carry the matter go police and dem don start to investigate the matter.


Chai! Badbelle People Don Kill One Lawyer After Him Withdraw Money From Bank Inside Bayelsa...




From Deborah Odoekwu.. .

Chai! Wicked tins dey happen for this country o!

I dey talk dis one sake of say dey don kee one lawyer, wey im name be Pumokumo Abel Ozi for inside Bayelsa State. This man wey been die so na member of Human Right Committee wey dey for bayelsa state. The story wey follow the matter be say im bn go withdraw im money from one bank n aim dem come kill am.


We hear say dem shoot this man for correct afternoon for Opolo wey dey that Mbiama-Yenagoa road wey no far from Police Area Command.  Dem still shoot the man driver together with two other people wey dey the car wey dem carry come thebank, come collect the two million naira wey im go withdraw from bank. We still hear say this people wey kee this man bn follow am till he enter im car, dem come shout for am make e open im car but as e no green a im dem come shoot am come kill am.


Now the colleagues of this lawyer wey be im fellow lawyers for Bayelsa State, under Nigerian Bar Association, NBA, for Yenagoa and Sagbama , come dey enter all the streets wey dey there dey vex say dey must serve justice for wetin happen to their colleague, come say the way bad bad tins dey happen for Bayelsa especially for Yenagoa, e dey too much, say the security agencies for there no dey do their work well.

Hmmm! For these people to raise this kin voice for the matter, e mean say the matter don’t reach dem for neck. Abeg make the security people wey dey Bayelsa state wake up so that all this matter no go dey enter ear.

Yahoo Boy Wey Been Pretend To Be Woman, Don Scam One US citizen of $2300...






From Ayim Raymond...

The Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, Ibadan Zonal Office, today 22nd January, don cari one Ajibade Wasiu Oladotun, go stand before Justice M.A. Onyetenu for the Federal High Court weh sidon for Osogbo, inside Osun State ontop three-count charge weh be bordering on obtaining money by false pretence and possession of false document (weh be say him use kuru-kere way, dey collect money from people).

One statement from the anti graft agency talk say, one of the counts as them read am, be say:

“You, Ajibade Wasiu Oladotun sometimes for the month of March 2017, for Ile-Ife inside Osun State, within the jurisdiction of this Honourable Court, with the mind to defraud,  pretend and collect the sum of $2,300 (Two Thousand Three Hundred Dollars) from one Chris Odom weh dey stay for United States of America, under pretence say you be woman and your name na Lola Parker, and you dey ready to marry am and say the money na part of the air ticket weh go cari you for KLM flight from Lagos, Nigeria to go meet am for United States of America, when you know say na lie you been dey lie. Sake of that, you committ offence weh dey contrary to Section 1 (1) & (2) and punishable under Section 1 (3) of the Advance Fee Fraud and other Fraud Related Offences Act, 2006”.

Oladotun beg say, him no dey guilty to the charges.

Prosecuting counsel, Adeola Elumaro, come apply for another date for trial while dem go remand the defendant for prison custody.

But the defendant, Babafemi Iyiola, come move for bail.

Justice Onyetenu grant the defendant the sum of N20 million as bail and two sureties weh get the same amount of money and one of them must be Civil Srvant  not below grade level 14.

Them don adjourn the case to February 26, 2019 for trial, and the defendant go still remain for prison custody till him meet the bail conditions.

One Cherubim and Seraphim Prophet Don Receive Betta Beating Till Him Die, As Dem Catch Am Dey Chop Bread And People Shit For Ritual...




From Ayim Raymond...

Them don beat one prophet for one branch of Cherubim and Seraphim church, sake of say them gbab am dey eat bread with human been shit for money ritual.

The Prophet weh dem say na the head of Cherubim and Seraphim Church for Apata Isegun weh dey for Mathew street, Ado Ekiti, Ekiti State, dem beat am to death yesterday 21st of Jan for Odo-Ado inside the state capital.

We hear say Before them beat am, them first remove all him clothe come parade am along the streets to the front of him church before them come kill am.





Dem Don Catch One Small Boy Dey Theif Another Man Boxer For Inside Delta State...



From Ayim Raymond...


"Every day for the thief one day for the owner", na popular talk for Nigeria. Before now, the news weh we dey hear na say people dey thief female underwear or say them force them to remove am, and many people been dey think say e no affect the men.  But the latest news weh dey come from Abraka for Delta state now don show say both the male and the female gender all dey inside the matter oo. As one young man recently gbab one guy as him dey try to steal him boxers. The man weh them call him name as  Victor, share the video of the man as him see am, the try to thief him underwear, as him come the talk him say: “This idiot wan use my boxer buy Benz… He must buy the Benz today o”
https://www.instagram.com/p/Bs2ZkuIFYwp/?utm_source=ig_embed&utm_campaign=embed_video_watch_again

So for you weh been dey think say the underwear matter no consine you, take your eyes see am and take your ear hear am so that you go know how to hold your side ooo, open your eyes make them no use you buy Benz oooo.

Keke Napep Rider Don Land For Police Net Because Him Defile One 10-year-old girl Inside Akwa Ibom





From Ayim Raymond...



One Keke-Napep driver, Edet Edem, don enter police palava, sake of say him go use by force enter one 10-year-old girl weh them no call her name for Uyo, inside  Akwa Ibom State.
Edem, be 27, and him dey come from Oku Iboku for Itu Local Government Area of the state.
We gather say, this keke-napep driver cari this girl go drop for  Use-Offot market square as him see say the girl been the bleed (pure plenty-plenty blood) after him enter her finish. Na one passerby, weh be Mariam Daniels, come rescue her, cari her go Anua Hospital, along Nwaniba for Uyo for medical treatment.
Daniels, weh be member for one non-governmental organization, weh also be Journalists Alliance against Gender-Based Violence, talk say, e touch her heart wel wel as she see this girl  lay helplessly for the market square.
She add say she cari the girl go the suspect house, na so them come see plenty-plenty blood everywhere for the house.
“The suspect’s door been dey locked and nothing show say him been dey around that area” na so she come talk.
Quick quick na so the news spread everywhere, as plenty youth for the community come dey look for the man, before dem con later see am for where him run go hide for one pastor place for him home town inside Oku Iboku for the state.
As the suspect dey give him statement for Ewet Police Station, him confess say him commit the crime, say apart from driving keke-napep, him still be senior official for church.
We also hear say the wife of Governor Udom Emmanuel, weh be Martha Udom Emmanuel, don enter the matter and she don dey make sure say them go give the girl better medical treatment.
one senior police officer, weh collect the statement from the suspect, say dem go cari Edem go court wen them finish investigation.

Heartbreaking: Groom, Family Members Don Die For Fatal Accident, As Dem Dey Road To His Wedding...




From ALI INA...


This kind story no sweet to talk atall… Na the kind story wey some people go believe say village people dey follow some people true-true… See how celebration day con turn to mourning day… One man wey been dey road dey go him wedding, don die inside fatal accident along with some family members.


This one na wetin oyibo go talk say na really heartbreaking development, as this man die painful and tragic death ontop of him wedding day.

The development don cause plenty people to dey cry ontop the matter instead of to dey congratulate am for him wedding…

Local reports show say, the sad incident happen for  Kano state on Saturday, January 19th. The groom and some of him family members been dey involved inside this serious accident as dem dey go the venue of the wedding ceremony. The real cause of the accident, we never know sha. But some of the victims plus including the groom, been die immediately as some wey get some kind injuries like that, dem don rush them go hospital… Now see as the man wey dress to go him wedding, con go land mortuary… Make God help the bride and other family members of this man so that dem go fit bear this loss and Make him soul rest in peace…


Court Sentences Man To 3 Years For Stealing Mattress, Things Needed For A Home To Get Married in JIGAWA STATE



From ALI INA...


Hmmm! Na wa oo! E get some plenty plenty things wey no suppose to happen for this life but when dem happen, toh you no go fit blame the people wey do am or wey e happen to… One Sharia Court For Dutse, Jigawa State don sentence one 32-year-old man,wey be Usman Amadu to three years imprisonment sake of say him steal mattress for Yalwawa quarters inside Dutse local government.

The Sharia court Judge, Ibrahim Yusuf Harbo, been find am guilty of  two-count charge of burglary and stealing, wey dey contrary to section 193 and 148 of the penal code.

Harbo con sentence Usman Amadu to one year imprisonment with option of N20,000 fine for the first charge and two years imprisonment with option of N20,000 fine for the second charge.

The prosecutor tell the court say some of the stolen items include mattress, stoves, Iron, shoes, among others.

The accused, Usman Amadu talk say him steal the items because say him wan meet some of the demands of him fiancΓ©e.

Him explain say she no gree collect  almost all the things wey him do before wedding, con tell am say make him provide only N30,000.

 “She tell me say make I provide N30,000 only and I get N19,000. I no get other means wey I go take get the balance, that is why I con decide to go thief,  so that I go fit make up the balance,” Na so him talk.

Toh, as e be so, my mind dey ask me, Shey this wan na love abi na stupidity? Make you answer am for your mind…

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land