Monday, October 7, 2019

MIKE O EDWARD; NA BIG LESSON FOR ALL MARRIED MEN 4 NAIJA


 I throway salute to una wey be average Nigerian married Men, and i hope say you don learn something from Mike O Edwards of BBN season 4?

This thing wey oyibo dey call Infidelity(meaning say married person dey sleep with another person for outside him/her marriage) na choice ooo.
Na you dey responsible for wetin you dey do with your penis.
Wether You cheat or misbehave na because you wan do am, or you be dog, no be because you no fit control yourself.

Mike bin stay 99 days with different fine - fine ladies wey get better different sizes, complexion, height and shapes.
Him see them inside jenkpe clothes(even pant and bra), the type wey fit make any man start to pursue dem like he-goat, him even share bathrooms and bedrooms with them, but no time wey we hear or see say konji wan kill am.
We no even see anytime wey him behave anyhow for around any of them.
Him respect himself, him wife, him wedding vows and him brand, even though him know say our society for make some kind excuses for am or even forgive am sharp-sharp if him been play hide and seek  with any of the girls for that house.
Make una remember this one, anytime wey you wan make excuses wey no make sense, sake of say you no fit put "junior" or "John Thomas" for trouser or siddon one place as a married man or una go con dey put blame ontop wives of cheating Men.
Make una also remember this one, the next time wey  you wan justify to sleep with that house help, sister in law, colleague, neighbour, your wife best friend or your side chick.

If you like, make you Like or hate Mike, him really set good standard for married Men inside that house.
Him make one kind better point.  And as far as i dey concerned, na him for win am, if no be say all of us see am as person wey already don get money well well and him na made man already... My Advice na, make una Man up like Mike!πŸ‘πŸΎ
But make we no forget to throway Big Congratulations give Mercy Eke! πŸ’ͺ

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land