Wednesday, October 23, 2019

Jennifer Kemi Martins; Na Recipient For The African Giant Strides Awards For The Fast Rising Actor of The Year Category...

We still dey the season wey we dey torchlight Beautiful and Handsome people wey dey make waves small-small on top the kind career wey den dey pursue and the kind things wey dem dey do... And as una know, Nollywood dey grow, their films dey betta... And as e dey betta, na so new faces dey enter the game... Today so, we don get another Nollywood lady wey her skin fresh pass Jos tomatoe... Her smile kuma, get capacity to take style knack you akpako(if you no stand well for ground)... Lol! And her name na Jennifer Kemi Martins...

Many of Una know her as Una don dey see her on top plenty films dem, but others still never sabi am. And dat na part of the reason why we dey torchlight dem and d kind Giant Strides wey dem don make so dat all of us fit learn one or two things from them... Oya, as usual, make we allow our Giant take her mouth chop onions first-hand!
"My name na Jennifer Kemi Martins. Na for Kano on the 23rd of July na im my Mama born me. I been do school for Mayor international school inside Kano for Primary, then my Secondary na for Christ Ambassador college inside Kaduna, before I con do my National Diploma for Federal Polytechnic Ado-Ekiti, before las-las I con obtain BSC for National open university of Nigeria..." Omo! No wonder dem talk say soup wey sweet, na money kill am... E dey show on top the way she dey do her work plus even d way she dey take mouth rap the pidgin sef, you ma go know say true-true pidgin sweet but to go school sweet pass! Lol! Oya! Make we continue... As she don reach dis level so, we con take style ask am wetin she don achieve since wey she dey pursue her career for Nollywood and which kind projects she don dey do since. Na so she talk say; 
"I don achieve plenty things by God grace and na within the space of 3years... Yes, I don dey industry for 3years now but I believe say as oyinbo dey talk am 'it is not how far but how well'(No be how far, but na how well) I don dey inside very good projects like PALACE  wey dey show on top AIT where I act as Wuraola(Goldie),  IYA MODINA wey dey show on top NTA where I act as Modina, E fit happen PSA for ontop BBC media action, Smokescreen, Black Elijah, and plenty others..."

Na for dis kind period you go hear person like Chiwetalu Agu of Nollywood, dey talk something like "Umu na agwa gwa gwa gwa cha cha cha... Hia"(wetin e mean, me sef I no know but your mouth suppose dey open inside surprise...)
Chai! Dis babe don waka o! No wonder wey Black Giant Signature find am worthy say make she also be one of the recipients of the African Giant Strides Awards... We go reach dat side sha, but make we continue as betta still dey for front... We still con ask her say na which kind Legacy she go wan leave so dat people go remember her wella... Na so d ever smiling babe yarn say;
"The Legacy wey I wan leave be say, make people call my name smile, make joy full their heart because of the positive impact wey I go don do for people..."
  Aww you see say all the African Giants so far get good heart to do good thing... OK, as we take style go front small as time no be our friend again, na so we con ask her which project dey on ground now wey she go like make we know about, she yarn say;

"The Project wey I dey work on currently na my own film wey I wan produce, something is cooking, una go see am very soon..." Correct! We go make sure say we put eyes and ears for ground to bring Una d full tori as dem cook am finish... For dis point when e con be like say her aero plane bin don dey give am signal, na so we con tell am make she give advice to some kind upcoming talents... She talk say;
"My Advice to upcoming talents be say make dem dey prayerful which na d most important, den believe in yourself, if you no believe say you fit make am nobody go believe you, den no ever give up!"
Na betta talk from betta babe b dis but on top her final talk, she yarn say;
"Another thing wey I go like talk be say make film makers especially for Abuja, make dem dey respect talent, give your actors wetin dey due to them, make the pay dey increase, thank you...." 
Toh, una don hear am first-hand from Jennifer Kemi Martins but make una no forget say she be recipient for the Black Giant Signature, African Giant Strides Awards wey dey come up next month(Nov 17th)... As her fans dem, make una try vote for her for inside The Fast Rising Actor of The Year Category and dis na the link;
http://elfrique.com/s/agsd2019

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land