Friday, January 18, 2019

Video: Watch As Billionaire Daughter DJ Cuppy Dey Cook Correct Seafood Soup and Eba...


https://www.lindaikejisblog.com/2019/1/video-watch-billionaire-daughter-dj-cuppy-cook-correct-seafood-soup-and-eba-2.html

Refugees: UNHCR say make Cameroon stop for force Nigerians back...


https://googleweblight.com/i?u=https://www.bbc.com/pidgin/tori-46927431&hl=en-NG&tg=85&pt=3

OMG! Corpse Of An Unidentified Teenager Found Lying On Murtala Muhammed Highway, Calabar From VIVIAN SUNDAY

   
OMG! Corpse Of An Unidentified Teenager Found Lying On Murtala Muhammed Highway, Calabar
From  VIVIAN SUNDAY 


Hmm God go help us o... Hmm as i dey waka dey drive for road, my waka carry me reach calarbar , na so i see some thing wey make me match break o.

I hear say dem don see the corps of one teenager for murtala muhammed highway
, by bishop monyagh avenue , Cross River State.
But as i take eye see the body , this teenager go dey around 13years. I no see any injuri for this teenager body except skin infection for Him waist.  Wetin make this boy die we never know but as soon as we get reason, we no go take time we go con tell you .
But as e be so dem don tell the police and order health authorities make them carry the body...

Two Notorious Hoodlums Stripped Nak3d, Beaten And Paraded By Soldiers In Nasarawa From Ali Ina


Two Notorious Hoodlums Stripped Nak3d, Beaten And Paraded By Soldiers In Nasarawa
From Ali Ina
Road don close for some notorious criminals after Soldiers gbab them for inside Nasarawa State.
Na so Dem give the Two suspected hoodlums the beating of their lives after dem gbab them…
According to reports, the suspects been don dey terrorize one community inside Nasarawa/honeypot Local Government Area of the state, before the military men con gbab them redhanded…
Dem first naked the men, before the soildeirs con beat-beat them, then con disgrace them for public…
Them later hand the suspects over to the police for further investigation and prosecution….


4. I won’t accept this child until paternity test proves I’m the dad, man tells wife(KADUNA STATE) From Ali Ina


   I won’t accept this child until paternity test proves I’m the dad, man tells wife(KADUNA STATE)
From Ali Ina

One 29-year-old woman, Rahma Yakubu, on Wednesday don drag her husband, Jibril Bajeh, go one Sharia Court wey dey siddon for Magajin Gari, inside Kaduna State, because say Him no gree say their three-year-old son, Abdulhalim, na him own...
Rahma tell the court say Bajeh been abandon her when her belle been dey eight months, because of one  misunderstanding wey them get.
She tell the court say, she and her newborn pikin been dey live with her brother after Bajeh cut off all communication with am. She talk say,
“My mother call am to tell am say I don born pikin for am, but him tell her say him no go accept the pikin until him confirm am through wetin dem dey call DNA test,” Na so she tell the court.
Rahma been also talk say their parents been don also try say make dem settle the matter, she even tell the husband say make him try to agree to take responsibility of the pikin welfare until when the result of the test go commot.
The complainant also beg the court say make them scatter the marriage since her husband don use mouth to divorce am already.
For him defence, the man tell the court say him divorce him wife for 2015 because of say she dey do touch-touch with other people even as she dey married to am, na that thing make am deny the pikin after them born am.
The Judge, Musa Sa’ad-Goma, come rule say “since the defendant don confirm say him want make their marriage scatter, the court go present divorce certificate to the complainant.”
Sa’ad-Goma still talk say the legitimacy of the child, that is who go get the pikin, dem go discuss am with the Parents on January 24.

Delta Polytechnic Student, Peace Vera Killed By Speeding Vehicle While Returning From School From Ayim Raymond


1.                  Delta Polytechnic Student, Peace Vera Killed By Speeding Vehicle While Returning From School
From Ayim Raymond
Haaa, wetin be the meaning of life? Wetin be d main tin weh person dey live for? Today you live, tomorrow you die, you see person today, tomorrow no more, you wey dey alive now wetin you dey do, to help yourself, your future and d people wey dey around you? You don ever ask yourself where you dey go if you no dey today again, and ee get any good thing weh people go talk about you wen you no dey? Just know say no body dey plan for death, ie fit come at anytime.
All this things weh I the talk, na from the kind thing weh I see for Delta State yesterday, after one motor weh dey for high speed, kill one young girl weh her name be Peace Vera as she been just the return from school.
Oh, I dey see plenty tears for the eyes of this girl family members as she just meet her end yesterday for this big accident inside Delta.
We gather say this girl and her friend wey be Ovo, been dey come back from their school wey be Delta State Polytechnic, Ozoro, wen one motor wey been dey for high speed come knock them down as them dey try to cross road go buy something for Effurun roundabout.

Them say Peace die immediately while her friend been get serious injury, them say them cari her go hospital but she dey for bad condition. 
So all her friends don dey mourn her for social media, ohh. Abeg try to guide yourself first, if you dey waka or drive for road, try to know how to do your waka, if you no no, try listen to Security and Safety Maters for Human Rights Radio, every Thursday from 7 to 8pm so that them go teach you to secure yourself.

Pastor nabbed with bag filled with female pants and bra in Auchi, Edo state


     Pastor nabbed with bag filled with female pants and bra in Auchi, Edo state
From Ayim Raymond
One man weh claim say him be pastor, them don gbab am yesterday with one bag weh full with plenty pants and bra for Auchi, inside Edo state.

According to reports, na members of the state Vigilante na them gbap this pastor weh dey waka dey preach in the mornings, come dey ask day, wehtin dey dey the big Ghana Must Go bag weh him cari dey waka with. 
Na so them come collect the bag come search am, as dem come see plenty plenty pant and bra, na so people come dey shout “ Ewooooo Pas…..tor” heyyy, from there, them come cari am go him church, na there, them come see the real pant and bra depot.

Just see as some dey spoil the woke of God, Chai! .

STREET BEGGARS WEY NO GREE HEAR WORD FOR KANO GO LAND FOR COURT


          Street beggars wey no gree hear word for Kano go land for court

From Busayo Olowookere
Kano State government  on Monday arrest 35 beggars across di state wey dey beg for street.
Na for 2013 former govnor Rabiu Kwankwaso pass law wey ban all forms of begging for any street for Kano.
Nabahani Usman wey be chairman of di Anti Street Begging Unit, tell news pipo say those pipo wey dis na dia first time wey dem dey catch dem, dem go release dem afta serious warning, but di ones wey don commit before na straight to court dis time.
"From time to time we dey go round to arrest beggars and di problem  aspect now be say you go see plenti pikin wey suppose dey school but dia parents or guardians carri dem come or lease dem to help dem beg."
One of di beggars wey speak to news story pipo been talk say na lack of wetin to chop make her dey beg.
" say If government go help me with moni to start business, I no go beg again," naso she tok.
Afta former govnor Kwankwaso pass di bill, di plan be say every month government go dey give those with disabilities chop moni for di state but till now dat plan still neva dey work well well..
From Busayo Olowookere

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land