Monday, November 25, 2019

STELLA ENE JOHNSON: "I dey do cake, I dey do hair, I sabi dance, I sabi act & I sabi sing..."

Days don pass when ladies go siddon dey wait make man con do everything for dem... These days d belief be say wetin man fit do as hussle, woman fit do am times 2...πŸ€” Omo! πŸ™„Dis na true because d hussle wey we dey see for Naija dey real... Na dat wan con make us land for d domot of our guest today wey be young girl wey dey hussle hard to make name for herself and to make sure say she no go be burden to any man or anybody at all... Oya make she use her own mouth introduce herself;


"My name Na STELLA ENE JOHNSON... Dem born me for wuse Abuja on 21th august 1997... I do my primary school for pilot science primary school for masaka nasarawa state... I come do my secondary school for government day secondary school masaka nasarawa state..." Hmm Una don hear am from Stella Ene Johnson, wey no gree tell us say na from Benue she come from... Oops!🀫 Make I leave matta for Matthias before dem pour me hot water ooo...😁 Na who Stella Ene Johnson be?; "I go still say I be student because I go like go back school..." Chai! See betta pikin, at least from her talk, you go know say she value education and dat wan na good thing.. Anyway, unto wetin she dey do right now, she talk say;

"Right now the thing wey I dey do plenty ooo... I dey do cake, I dey do hair, I sabi dance, I sabi act, I sabi sing..." You bin recently contest for Face of Arts Beauty Pageant(FABP), how d experience?; "Yes I bin contest for FABP...
My experience good ooo because as I don contest for this one, I don learn many things ooo and I come meet many people  I make new friends, I come get new ideas..." Toh as e be so, wetin you go like achieve with wetin you dey do?; "I go like achieve many things, I go like be face for one big company or even magazine sef... I go like go far by the grace of God. I go like even contest for Miss Nigeria sef..." E good to dream big but d most important thing na d steps wey you dey take to achieve your dream. And for Stella Ene Johnson, we fit say she dey on d right track, so we no go surprise when she hit the big stage wey she don already dey dream about... We no get much time so make we sharperly move go front... As per who she go like be like for d thing wey she dey dream about and she dey do, she talk say;
AISHWARYA BACCHAN RAI
"D person wey I go like be like Na AISHWARYA RAI..." Correct! For those wey no know Aishwarya Rai, she don be one time Miss World 1994 and currently na Bollywood Diva... From dis wan, Una go agree with me say, Ene dream pass be careful ooo... Lol!πŸ˜€πŸ˜ƒ As per how long she don dey dis game and how long she wan dey do am, she talk say; "E never too tey wey I start ooo but I go like do am for long... I go like make history with am..." Toh, Ene na one young babe wey dey very interesting to gist with, plus you go know from her talk say dis wan na Beauty with Brains... Unto which kind legacy she go wan leave, wey go make people remember her, she no waste time to talk say;
  "Yes I go like leave impact wey go make people no fit forget my name... Wey go make me be inspiration for everybody..." Hmm dis babe sabi yarn sense no be small! Make we continue before we match break for dis interview... Any project dey wey you don do or you join body with person do?; "Non but I don dey try start my own project sake of say we no go leave everything for government we sef fit for our own little effort do better thing for we country Nigeria..." Chai! See as dis young girl dey think for dis age pass some kind graduates for dis country... Chai! Dis na challenge! Toh as time don go, to match break for here na so she con advice young people wey dey like her say;
 "My advice Na say make nobody tell you say you don fail make you free your sef... No see yourself as failure make sure say anywhere you see yourself, you do better thing. Make you always remember say anything wey you do, Na im dem go take remember you when you die. And always dey pray because with God all the things wey we want Na jara always think before you act... Omo! Dis babe don finish matta for here ooo! But anyhow wey e be, we dey wish Stella Ene Johnson betta luck wey go make her fly pass where she dey, so dat she go take style achieve her dreams... And if you go like reach her, you fit comment under here or for her social media handles:
Instagram:MHZ.STELLA
Facebook: STELLA JOHNSON

"My name na Daniel Boniface aka Holydanfilmz... I be Filmmaker"


For filmmaking, wetin people dey see and celebrate, na d efforts and work wey d Actor dey put inside so dat viewers go get betta pleasure with their eyes... But reality be say, much of d work na d people wey dey behind d Camera dey do am... Part of wetin we dey like do for dis blog na to celebrate every single member of every work of art and for every field of hussle wey dey exist for Naija... Today our guest na person wey don hussle behind Camera sotay him don become force to reckon with(as oyibo dey talk am)... Make we meet dis young man;
"My name na Daniel Boniface aka Holydanfilmz..."
Yes oooo today na Holydan turn. As plenty film people know am as d guy behind d camera wey professionally dem dey call 'Cinematographer'... E go good make we celebrate am bcoz d work wey him dey do, no be here ooo...  Make we continue d gist with Holydan... Him talk say; "dem born me for Abuja for January 30 1989, and na for GSS Garki, ABUJA, I go school..."  For d benefits of people wey no know who Holydan be, we con ask am, who him be, na so him tell us say;

"I be filmmaker..."
Omo! Dis guy no dey talk too much ooo, so to even extract 1 page information from am sef, na wahala... Him answers na straight to d point and for reality na straight forward person wey no like corner-corner him be... Ok as we take style move front small, we ask am say how long him don dey inside dis game, him yarn say; "na like 5years now..." Unto who him dey look forward to be like for d industry, him talk say; 
"seriously I be myself I no wan be like anybody..." Toh Holydan na one man army and him like am like dat... But as for how long him wan pursue dis career, him yarn say; "how long I want do am, na till God call meooo..." Unto wetin him go like leave wey go make people remember am, Holydan no waste time to say na; "good life.." OK as e be say time don dey give us signal, na so we sharperly ask am wether project dey wey him dey do or wey him moi body do? Him yarn say;

"Yes the project wey I join body with, na Face of Art Beauty Pageant/African giant strides awards wey Black Giant Signature bin organize" Toh as e don reach dis level naw, wetin be your advice to upcoming guys and babes wey go wan follow your path and wetin be your last words before we put full stop;

  "I want make dem understand one thing say d greatest barrier to success na the fear of failure... And wetin i go like talk be say una don try well well for this things wey una dey do because una help us grow the more God go bless una..." Una don hear am first hand from Daniel Boniface aka Holydanfilmz...
Incase you wan reach out to am, you fit comment under dis post or through him social media handles;
Facebook: holydanfilm 
Email: holydanfilm@gmail.com

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land