Tuesday, January 15, 2019

Bishop defrauding in God’s name arrested by EFCC... 

Deborah Odoekwu.


You see when some pastors dey use their church mind dey tell people make dem sow seed, some other people go dey use the opportunity make dem take chop people money. As I dey talk dis one, dey don The Economic and Financial Crimes Commission, EFCC don gbab one Bishop for Delta State sake of say im dey use God name dey do people 419.
This Bishop weyim name be Giniko Obi, n aim be the founder of Beloved Gideon foundation for Agbor wey det Delta state. E even get their branch for Bayelsa o, Onitsha, Lagoso, Port-Harcourt o and even Abuja. We hear say dem arrest am sake of say imbn do plenty people 419 and the money wey im don collect don enter millions of naira. Im dey collect their money come dey tell dem say e dey help dem to fight poverty.
Giniko Obi wey talk say im no dey do 419, still talk say im just dey do God work and im dey try help the people make poverty run commot for their life, say im just want make people no dey suffer as God too no want make dem suffer, n aim make am go do this tin wey resemble wetin MMM bn do plenty people dat time.
This bishop wey dem gbab come dey claim say im get diploma for theology, say im dey too holy to dey do that kin tin. He come talk say im just commot from Agbor go agos so that im go fit expand the business but the people wey bn put their money inside no come gree for am.
Im come talk say im don write some books, don organize seminars and workshop dem so that dem go use am train people on how dem go take make am for this life, say dem go tell the people say if dem register with #10,800 dem go give them #15,000 and if dem register with #18,000 dem go give dem #23,000. Im talk say imbn get about 30,000 people wey register and im dey pay dem, say supposing dey allow am make e go do the training wey imbn wan go do for Lagos, im for don pay dem their money.
One of the people wey bn register for the kin tin wey her name be Janet amakOkafor talk say this Bishop bn come tell dem say im from Gideons International wey dey America, say this man even kneel down dey swear with Bible say im come from America. She kuma come register with 310,800 and she come get #15,000. Na so im come use dem do customers o. she come talk say she as she dey even bring plenty people make dem come register and if you plus everything wey dem take register e go pass #5 million.
Another person wey dem scam, wey her name be Bessie Nwadibire wey be 67 years old, come talk sayb this Bishop bn don dey do konikoni since when im start dis business. She talk say when him bn come market he come dey share drinks, dey dash people money wey go reach #50,000, say poverty don too much for Nigeria. She come talk say she just dey pray make im give am back her money.
As she dey happy say EFCC don gbab the Bishop, she come talk say before dem arrest am, she with all the other people wey bring people for the business come dey hide sake of say the people wey dem bring for the business talk say dem go fit kill am if she no bring back their money. She say the money wey those peole put go pass #8 million naira.
According to the EFCC people, dem go soon carry the matta go court.
Make una shine your eye plus your brain o! people no dey smile again. E no dey hard for people to scam even their family members o. so open for where you dey chuk your money.

Newborn baby abandoned in a bowl, rescued in Edo...

Deborah Odoekwu


People dey find pikin, dey fast, dey pray, dey sow seed, dey spen better money make dem take get pikin but some people go just get am free of charge still come get mind to thruway am. I no know who you be but if you get this kin mind, devil dey do apprentice for where you dey. Dem suppose give you land make you build your own hell fire.
Hmmm!  We wan move commot from Edo State before we come reason am say e go make if we piece first before we continue to dey move. As we come step down from the bus, as chuenchuen no dey pass our ear like dat, we come hear say dem abandon one newborn baby for Uromi. From wetin we hear, dem keep dis pikin for inside one basin, come drop am near Catholic Diocese of Uromi. Na the cry wey the poor baby dey cry n aim enter the ear of the gateman wey dey the church. Person wey dey when dem see thspikin talk say the gateman bn see dis pikin as dem dey do adoration, say dem come for adoration around dah kin 5 minutes after five for early mormor, n aim this gateman come see the pikin. As dem see the pikin, n aim Rev. Fr. JohnBoscoEzehi just rush carry the pikin go hospital.
This one now dey happen after person been rescue one pikin wey don reach six months, wey dem abandon for inside one forest wey dey Obosi for Idemili North Local Government.
Now as etake concern this matta, Mr Duff Ibanga wey be the gateman wey find this pikin, talk say im carry this baby boy as im hear as the boy dey cry seriously. Im talk say e suspect say e no tey dem dump that pikin for there before im come see the child.
Na wa oooo. I just hope say dem go take care of this pikin well o. if you know say you  no go fit take care of pikin, why you come get belle na? even if you be rape victim, you no suppose thruway your own pikin o because the child no commit any crime and you no know whether the child n aim go change tins for you. No child be mistake o so no use your hand take block your progress.


Blind gospel singer accused of defiling his tenant’s daughter... Deborah Odoekwu


Na this kin tins I no dey quick understand. How the man take catch am sef? Me sef I don tink tire. Make I give you this chuenchuen so that you go follow me tink. No be only me go tink this one.
Hmmm, we just enter our Nigeria A-Z on a normal level, n aim we come match brake for inside Edo State. Na for that Edo state n aim we hear say one 49 year old blind man wey dey sing gospel song, wey don rape im tenant pikin. Police con visit this man sake of say im rape this girl wey be 9 years old for im house wey be house number 9 for Isidahomen street wey dey Ekpoma for inside Edo state. This man wey im name be Anthony Okhiria come talk say im no rape anybody, say musician wey e be and im dey sing Christian music. Anthony Okhiria talk say im senior brother n aim get the house from their papa but im dey stay for Lagos so im brother come put am in charge of the house as im no dey stay for Edo state.
Im talk say the mama of this girl dey stay for the house together with her four children, say na their church dey pay their rent for them. One day n aim the woman come tell am say their church say dem no go pay rent for am again and she no wan pay am im. From wetin the man talk, this woman come dey try seduce am but im no gree. Na im she come meet am one day, come dey tell am say she dey feel say im like am but im come come tell am say, no be she go tell am whether im like am or not. The man still talk say this woman children dey come im room dey do nonsense nonsense tins, say if dem come im house, im dey pursue dem commot. Im come report give the woman say im no like how her children dey come im house dey do nonsense, but the woman come tell am say, na play her children dey play with am. Im come tell am say, e no like dat kin play o because na Christian him be o.
According to wetin the man talk, this woman pikin wey dem talk say im rape, dey come im room sometimes when e dey sleep, come dey touch im legs, say even the girl mama dey come inside im bedroom. say e even reach one stage wey im go dey rob cream for im body, this woman go just enter imparlour, see say im dey naked but instead make she go, she go just dey there dey look am.
Im talk say na one day o when this woman just come tell am say her daughter wey be 9 years old come tell am say im dey sleep with am, say as she talk am, im just shock.
Las lasim come talk say  im no like as im dey for this kin problem, say im no rape am and na lie wey dem dey lie for am
Hmmm. Tohuna go join help me tink this one cos my brain don knock for this one. I don turn to Tinkerbell where I dey tink the matta. I no know who dey lie and I no know who dey talk true. Na report wey dem say make I do. The thinking part, na you go do am.



Man dressed as woman caught with pants in female hostel in Ogun State. ..
Ayim Raymond

Hennnn….hennnn..hennn, like play like play this pant issue don dey pass hand ooo, e start from south-south now ie don dey rush go south-west.
Yesterday dem gbab one man weh dress like woman as him go thief plenty pants for one female hostel for the Ogun State collage of Health Technology for Ilese-ljebu.
According to report, the suspect been go the hostel say him dey sell Ice Cream, but wen him comot, the bag weh him cari come big pass the way weh him cari am enter the hostel, na this one come make the security guards to search am, come see say na pants full inside the bag.
As them gather am, na him them com still see say na man, him just dress like woman so that him mission go dey easy.
Dem later hand over am to police for beter investigation.


Judge sentences 5 men to death by hanging for armed robbery...
Ayim Raymond.

One Osun State High Court weh sidon for Iwo, on Monday, don send five men to go die by Hinging sake of say them get hand for armed robbery.
This people weh their name na, Ifedayo Adebiyi, Semiu Taofeek, Afolabi Ogunwale, Oyeleke Mukaila and Ogunbayo Joshua, dem been cari them to go answer question for court on September 23, 2016, ontop three counts charges weh be armed robbery and unlawful possession of firearms, Wey dey contrary to sections 6 (b), 1 (1) and (2) (a) and e dey punishable under Section 1 (1) of the Robbery and Firearms (Special Provisions) Act, Cap R.11, Laws of the Federation of Nigeria, 2014.

According to Punch Metro, The prosecution counsel, Tijani Adekilekun, talk say the accuse been rob one Mr Fabiyi David of him things, including one Lexus SUV motor, for Emmanuel House, opposite  P.P. Hotel, Olupona.
Police come letter gbab them with the motor for Guru Mahraji area for Lagos-Ibadan Expressway.
For him judgement, Justice Akin Oladimeji talk say the prosecutor prove him case beyond reasonable doubt and him see say true true the accused dey guilty.
Justice Oladimeji come sentenced them to death by hanging.


Man Shocked To See 13-Year-Old Boy Drinking Beer At A Nigerian Bar.

Ali Ina...

Wetin dey happen to good home training? Wetin dey happen to moral upbringing? Wetin dey happen to this our generation? All these questions come my mind when I hear this story wey I wan tell una so, so that una sef go fit ask or find answers to the questions…
One Nigerian man wey him name na, @Jumabeeforinstagramtalk say him been dey  shocked to see one 13-year old boy dey drink beer for one bar inside Benue state. Him talk say,  the 13-year-old boy, been buy 4 bottles of beer and him finish everything… Chai! Na so him siddon there with so much confidence ooo and the boy even talk say, him don dey come the bar with him uncle, since him been dey  11 years. This na the kind thing wey dey make one Nigerian Actor wey him name na Chiwetalu Agu to shout, akakuluomaokwakwakeluebubekpamkpam! Chai! Make una hear wetin Jumabee write…
''So i been dey one meeting with friends for inside one bar for Benue and dis young boy just bounce enter with so much confidence, con siddon, order for one bottle of beer...Uwuu! As an African man wey I be, e been dey difficult for me, make I just turn eye like say the thing no concine me, because I ask myself say, what if the boy na my small brother??  Na so I con go ask am how many years him be, this boy just smile come ask me, brother why you ask? I come tell am say, because you look too young to dey here. The boy con say, i be 13years old but I don dey come here with my uncle since I been dey 11...
Inside the shock wey I dey, na so i ask again, how you get the money to spend, come buy beer… Na there the boy face con dey change like say, e be like say I don dey ask too much questions... So I just waka go back to my sit con dey take style to video the boy… Na so the boy order four more bottles, con dey swing him legs for chair, dey watch match as him dey drain all the drink with one bottle of coke… Now, fear don dey catch me for this generation ooo, becoz we no dey pay attention to our children again...Parents abeg, make una dey put eye ontop una pikins dem, especially the kind of friends wey dem dey keep and the things wey you sef, dey do for dia presence... For the youths, make our love for money no make us ignore our morals.''



Serious Embarrassment! Abuja Youth Corper Ordered By NYSC CoordinatorTo Kneel Down In Public.

Ali Ina... 

Oyibo talk say Respect is reciprocal… Meaning say if you respect me, me sef go respect you… E be like say na the opposite of wetin happen for Abuja, when one corp member of the National Youth Service Corps(NYSC) been get the most embarrassing moment of him life, as dem order am say make him kneel down for public… Chai! Na so the bobo take shame kneel down as him no fit do any other thing because the order come from above…
We hear say, na the NYSC state coordinator tell am say make him kneel down, sake of say him try to leave, during the address wey him been dey give corps members…
We never know the name of the corp member sha, but for the video wey don dey trend for social media now, na so the corp member kneel down for public as other corp members just dey look am, dey wonder the kind embarrassment wey him dey go through… This thing wey dey sad and embarrassing don make people dey talk about am, as some people dey say, why dem go do this kind  thing wey be inhumane treatment for any graduate… Say, even if dem go punish the corp member, na only to kneel down dey available? Another person say, so President fit tell Minister make him Kneel down for public because him wan commot as him dey talk? I no understand… Toh!  Anyhow wey you see am, you dey entitled to your own opinion…




EFCC arrests Ugly Rex, two other Yahoo Boys

Vivian Sunday.


We hear say operatives of the economic and financial crime commission (efcc) port Harcourt zonal office, don arrest three suspected 419 as they benn dey carry  out one of their operations ,the suspect wey their name adugwerexodinaka , aka  alhaji ugly rex , igwe prince chukwuebuka aka tradmarley and ifeanyi Nicholas chukwulena , they arrest this suspect for omoku , rivers state .
We hear say investigation show say chukwuebuka and chukwulenwa been put their hands for romance and dating 419 and say they don succeed to get three American people  t
Odinaka for him own part they do 419 wey hin take they collect gift cards 
We still get report say through this suspect  wey they catch they don get other members wey dey into this 419 business and say they go soon charge this suspect to court...




Man arrested for stabbing his wife to death in Niger state ...
Olutimain Alvin.


Them don arrest one 39 years old man wey him name na Farida Banti, for Hungu village for Mariga Local Government Area of the state,  because of say, them say him kill him wife, wey her name be Maijari, with cutlass as them been dey fight. 
Banti been dey tell newsmen, say him wife no get manners, and say him been wan send am go back to her mama house make she learn how to behave. Him talk say them been get small quarrel, say him come use vex carry cutlass,  Banti talk say him regret watin him do, but say make all this new generation women learn how to respect their husband.
As him take talk am, him say:
“I been cut my wife as we been dey fight, but I no plan say make the cut deep as e take deep. But the cut na him make her die, because of say she been no wan dey obey me. Wallahina because of exreem vex wey I vex, na him make me kill my wife. I wan tell all women make them dey respect their husband so watin happen to my wife no go happen to them.
(laughs) this kind advice from Bantu weak me small o. because of say provocation or disrespect from your woman, no be reason to kill am, or even beat am.
Anyway, them go carry Banti go court when them don finish the investigation. And we pray say make justice prevail.





Come o!  Shey you wan get customers plenty like Brekete Family Program? Toh! That one mean say you gast  advertise with us ontop Human Rights Radio 101.1fm... Oya,  sharp-sharp, no waste time o!  Just begin to call or whatsapp me Ali Ina - 08060959221. Make we talk about am...

Facebook : Human Rights Radio
Twitter : @humanrightsrtv
IG: @humanrightsradiotv
You go get chance to win ogbonge plus betta-betta prices ontop our weekly quiz...




ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land