Tuesday, January 15, 2019

Newborn baby abandoned in a bowl, rescued in Edo...

Deborah Odoekwu


People dey find pikin, dey fast, dey pray, dey sow seed, dey spen better money make dem take get pikin but some people go just get am free of charge still come get mind to thruway am. I no know who you be but if you get this kin mind, devil dey do apprentice for where you dey. Dem suppose give you land make you build your own hell fire.
Hmmm!  We wan move commot from Edo State before we come reason am say e go make if we piece first before we continue to dey move. As we come step down from the bus, as chuenchuen no dey pass our ear like dat, we come hear say dem abandon one newborn baby for Uromi. From wetin we hear, dem keep dis pikin for inside one basin, come drop am near Catholic Diocese of Uromi. Na the cry wey the poor baby dey cry n aim enter the ear of the gateman wey dey the church. Person wey dey when dem see thspikin talk say the gateman bn see dis pikin as dem dey do adoration, say dem come for adoration around dah kin 5 minutes after five for early mormor, n aim this gateman come see the pikin. As dem see the pikin, n aim Rev. Fr. JohnBoscoEzehi just rush carry the pikin go hospital.
This one now dey happen after person been rescue one pikin wey don reach six months, wey dem abandon for inside one forest wey dey Obosi for Idemili North Local Government.
Now as etake concern this matta, Mr Duff Ibanga wey be the gateman wey find this pikin, talk say im carry this baby boy as im hear as the boy dey cry seriously. Im talk say e suspect say e no tey dem dump that pikin for there before im come see the child.
Na wa oooo. I just hope say dem go take care of this pikin well o. if you know say you  no go fit take care of pikin, why you come get belle na? even if you be rape victim, you no suppose thruway your own pikin o because the child no commit any crime and you no know whether the child n aim go change tins for you. No child be mistake o so no use your hand take block your progress.


No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land