Wednesday, December 18, 2019

NWAMODOH STEPHANIE: "I dey contest for Miss Nifest for inside Nasarawa and i go like am if una go vote for me, your favorite girlie..."

Beauty Pageant Contests don full everywhere now and dem dey give platform for our young girls to showcase their talents and use their intelligence take style impact humanity... Na dis wan make us jam dis beautiful young babe with so much intelligence and charisma wey wan use modeling/pageant to take style contribute her own quota ontop nation building... Make we meet her so dat we go hear from her;
 "My name na Nwamodoh Stephanie... Dem born me on d 23rd of October..." Even for dis her young age when other babes her age dey form Americana on top pidgin, Stephanie just speak pidgin like say she no send say na fine babe she be... She just flow naturally on top d language like say she follow invent am... 😁Lol! As we continue from there go her educational background, she talk say;
 "I go primary school for Tadel Model Primary Schoolschool for Mararaba.... I come go Federal Government Girls College for Bwari inside Abuja...now I dey Federal Polytechnic Nasarawa dey study marketing..." WowπŸ€— education na d bedrock for every endeavor, na wetin dis beautiful young babe don prove so far because d way wey she dey yarn, πŸ˜ŠπŸ˜‰anybody wey get sense go know say, dis wan sabi something...πŸ‘πŸ½ Make I know hype her too much but na d truth be dis...🀷🏽 As we continue again, na so we ask her for d  occupation wey she dey pursue right now and she talk say;

 "Right now I be student but I also be part time Model..." Na for here we con ask her say, na how she take be model?πŸ€” She tell us say; "Ah this modeling issues sef don dey my mind for long as I see opportunity for school na e I take grab am so..." ☺Wow! Na only person when know wetin e want, dey know opportunity when e show...πŸ‘ŒπŸ½ And Stephanie dey amaze me with d way, wey she dey reason like very correct matured Naija babe...πŸ‘πŸ½πŸ‘πŸ½πŸ‘πŸ½ Anyway, to continue especially as we reach wetin make us notice her, na so we ask her say, we hear say you dey contest for something, wetin be dat and how you want make we support you? Sharperly, she respond say;

"Yesso I dey contest for Miss Nifest for inside Nasarawa and i go like am if una go vote for your favorite girlie..." Alright una don hear am straight from Stephanie mouth, make we come out con support dis her correct hustle and ensure say we vote her to win dis contest but before dat wan, we go like to know wetin you go like achieve If you win dis contest? As intelligent babe wey she be, she sharperly yarn say;

"If I win dis contest bah I go like inspire young models like me.. Because I be dis shy girl wey no Sabi talk plenty..." Hmm na dis kind thing oyibo dey call 'inspiration by example'... Toh I don dey ready to go vote for her oo coz I dey really feel her intelligent approach unto wetin she dey pursue... πŸ™‹πŸ½Make una make sure say una follow me ooo!πŸ’πŸ½ So on top general note, how far you go like go for dis modeling path wey you don choose to follow? She yarn say; "Ah go like do am 2 dey successful..." Na so! As nobody dey ever pray to fail for anything wey dem dey do, na so we sef go dey pray make Stephanie succeed as Model so dat she go fit inspire others as she don talk say she wan do am... As time no dey our side again, na so we ask her wetin be her advice to others wey dey like her for dis career path and she yarn sharperly say;
  "My advise for young models like me b say... No let fear-fear stop your dreams of achieving wetin you want.. Fear for dis life na bastard so always be up and doing.. AND no forget ooo.. Put baba God first in everything..." πŸ™Na here she finish me, coz na only Beauty with Brains dey ever remember say one with God na majority... 😁And na God pass everything... πŸ€—Toh las las, on top her sign out words, she talk say;
 "Abeg I also get ticket wey una fit buy from me... Abeg help me.. Let's win dis 2geda..."
Omo! If you get conscience when you see fine intelligent babe wey get manners like Nwamodoh Stephanie, you no go waste time to go vote for her Like 5 times or even more sef Like I wan go do now....

Abeg make we make d right choice to vote Beauty With Brains like our daughter, sister, friend and soon to be super model  Stephanie Nwamodoh, make we all help her win, God go bless una well well... Just click dis link to vote πŸ‘‡πŸ½
https://meenatnigeria.com/nacfest-online-beauty-pageant-voting-page/πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½

No forget to just indicate here if you don vote or on top her social media handles wey be:
FB: (Stephanie Anthony)
INSTAGRAM: (Darien009)

Make we go digital make we give Stephanie Nwamodoh dis chance to make betta difference too!

Make sure say you still click here to support our correct hustle after you don vote Stephanie Nwamodoh... πŸ‘‡πŸ½πŸ‘‡πŸ½πŸ‘‡πŸ½
http://ducolomal.com/2439πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½πŸ‘ˆπŸ½

Court Don Convict Policeman Because Of Accidental Discharge.


No forget to click here to support our correct hustle ooo πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1ywmπŸ‘ˆπŸ½



From TESLIMAT UTHMAN.

The lagos state high court for ikeja don dash one police seven years imprisonment sake of say hin carry AK47 gun take shoot one security guard wey dey work for one bank wey dey epe area.

The policeman wey hin name na Ibrahim Salisu confess say  hin bin dey test the gun as the armourer bin don tell am say dem just service am, say as hin com shoot, na im the bullet go mistakingly meet this security man, the man com die o.πŸ™†πŸΎπŸ˜³πŸ˜¦πŸ˜§

As the crime break the rule of section 227 of the criminal law of lagos 2015, Justice Raliat Adebiyi con sentence am to 7 years imprisonment but as e be say the man don spend 6 years and 5 months for prison dey wait trial, dem go minus am from the 7 years wey hin suppose use.

No forget to click here to support our correct hustle ooo πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1ywmπŸ‘ˆπŸ½

One correctional officer go go tanda for prison, sake of say e go chook hand for employment wuru wuru...


Support our correct hustle... All wetin we need you to do, na to just click dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1yAPπŸ‘ˆπŸ½ skip d add shikena! And God go bless you nyafu nyafu...

 From NENYE NWOBU.


The high court wey dey for Abuja say e don grab one man wey dem say na officer for Kuje correctional Centre, him name na Ahmed Abdu, and e go dey four year for prison house because say e go chook hand for kurukere waka wey oyibo dey call fraud when dem dey give people work.

Independent corrupt Practices and other Related Commission wey be ICPC come make us know say dem bring Abdu come court for 2014 by den, because him use wuru wuru collect one Adamu Abubakar N250,000. And dem say him don collect dat kind money from five other people sake of say e go give dem work for any work wey dem choose inside; Nigeria Immigration Service, Nigeria Civil Defence Corps and Nigeria Correctional Service, e even sign undertaken say e go return their money if the thing no work...

ICPC, for wetin court dey call two-count charge, tell court say make them tinap this man because e dey use him position dey do kurukere waka with people money for work wey no dey exist. Say this thing wey e do, dey against section 10(a) (ii) of Corrupt Practices and other Related Offences Act, 2000 and so dem fit punish am under that section.

Before dem sentence this man wey dem dey call Abdu, who nobody represent for court, the man beg court make dem take am softly for him punishment, because say na this be the first time wey him dey do this kind thing and say na him be first pikin wey im  mama born for him big family, e no go like make im  people suffer because say na him be their hope so...

The ICPC counsel wey be Ngozi Onwuka say make court make Abdu pay all the people wey him collect their money.

Justice Kutigi wey dey decide this case say e understand say Abdu dey beg say make dem take am jeje with am but say the only thing wey court give am power to do na to enforce law. So because say this case so, don show say true true, Abdu dey use im  position as public officer to do some kind bad bad things like this money matter so for job wey no dey exist. And na so the Judge come complain say this thing wey this man do so don full everywhere for we country, so the thing wey court wan do so na to make other people no follow Abdu hustle so e go put this man for two years inside prison with no option say maybe if e pay fine dem go fit release am and say na so e go dey do people wey still commit this kind offense.
Support our correct hustle... All wetin we need you to do, na to just click dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1yAPπŸ‘ˆπŸ½ skip d add shikena! And God go bless you nyafu nyafu...

THREE DIE, EIGHT INJURE FOR OGUN CRASH

Abeg no forget say, after you read am, try support our correct hustle by clicking ontop dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1wsAπŸ‘ˆπŸ½ Na only God go bless well well!

From HALIMAT OLANREWAJU.


THIS MATTER OF WRECKLESS DRIVING DON TIRE ME... WE DON  SHOUT! WE DON  YARN! WE DON PARIWO! BUT DEM NO GO HEAR!
One bus don crush three people to death con injure 8 for sagamu inside ogun state.
As we con dey checkmate d matter, we con find out say d driver wey drive d motor bin dey run as him dey drive, nah hin make am loose control go hit people wey dey their own jeje. Na so three people take die oo... But dem don rush other people wey get injury go hospital.
We pray for those people wey die say, may their soul rest in peace...

And una wey dey drive, make una sofry jeje for road ooo, especially now wey na festive period... Person wey get ear, make him hear ooo!

Abeg no forget say after you read am, try support our correct hustle by clicking ontop dis link πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1wsAπŸ‘ˆπŸ½ Na only God go bless well well!

RITA FIDELIS CHAGWA: "I be Actress and Humanitarian worker..."



Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1qMQπŸ‘ˆπŸ½ skip d add and allow God make Him do d rest...

Correct hustle na d message wey we dey try preach for here and by God Grace we get catalogue of intelligent youths wey dey do correct hustle for Naija, because dem wan also contribute for their own small way on top nation building... Wether we like am or not na systems make up society, plus people wey dey d society... Some of these youths dey make betta impact on top different systems where dem decide say dem wan pursue their career... And dat na d reason why we dey like to celebrate dem on top dis blog because everybody wey dey make betta effort to succeed, need encouragement... Our waka today don lead us go d Palace of one Beautiful and Intelligent Adamawa State Sweet babe... Oh!🀦🏽 Make liver no fail me because dis babe sweet to relate with, I no go lie(πŸ€ͺKai! Na wetin you dey think?😲) 😊AnywayπŸ˜‰, as we dey normally do am, we go allow her take her mouth chop d onions by herself... Make we meet our guest today;

"My name na Rita Fidelis Chagwa... Dem born me for Shuwa, one development area for Madagali LGA for Adamawa State..." Wow! Make I no talk too much sha... Anyway, on top her educational background, she yarn say; "I attend Central Primary School Shuwa, come enter Christian Secondary School for d same Shuwa... I come get Admission for
University of Maiduguri where I bin study B.SC Health Education..."  πŸ€”Omo! I bin no know say Madagali get fine fine intelligent and intellectual babes like dis ooo...😍 Na there I go throway searchlight for wife now... πŸ˜€Lol!😁 As we continue, unto who she con be, so dat all of us go know where her career path dey and where her passion lead her to, she talk say;
  "I be Actress and Humanitarian worker..." Wow! Toh dis wan mean say dis babe get betta heart to serve humanity and na another point she don score for Madagali people be dis oo... 😘My search light don kukuma enter gear 2... 😍Lol!πŸ˜‚ Out of curiosity, na so we con ask am wetin be her drive, wetin make she dey pursue dis her career like so... She no think twice as she talk say;

"Na because of the passion wey i bin get for dis acting since when i dey small na in make I dey pursue am, and na wetin dey fuel my drive because with dis wan, I fit create impact on top humanity sef..." πŸ™„Dis babe reasoning dey leave me speechless Like Micheal Jackson bin sing ooo, na now i really con understand dat song wella...πŸ€” 😍My love searchlight for Madagali babes don enter gear 3 now so... 😘Lol!πŸ˜‚ Okay on top wetin she go like achieve with wetin she dey do apart from wetin she don already talk, she still talk say;
 "International Recognition, and like i talk before, i wan make good impact ontop people..." Na for here we con ask her say na how long she don waka for her career and as a simple and intelligent Madagali babe with sauce and respect to God, she yarn say;
  "To God be the glory, I don dey go places..." πŸ€”Omo! Dis babe don succeed to carry my searchlight and interest on top 😍Madagali babesπŸ‘©πŸ½ go gear 4... I hope her State Government dey see say na very good ambassador of her people she be so... 😊Lol! Toh, na who con be your mentor and person wey you wan be like for dis field? E no take her anything to sharperly answer say na;

"RMD..." Omo see levels! Some kind mentors dey wey dey give hype and others, levels... Dis na one of d kind mentors wey dey elevate person level like Rita Fidelis Level go soon change... πŸ˜‚Lol!😁 So as e be so we con wan kukuma know how long she don dey waka for her career path and she comfortably tell us say;
  "Na 3years now..." Wow, she no be new player for d game... No wonder when we ask her say na which kind thing she go like leave as legacy wey people go take remember her, she talk say; "Great legacy..." Okay as Time don dey give us signal to finish dis session of interview with Rita Fidelis, we con sharperly find out if project Dey wey she don do or wey she joinbody do and wether stars bin dey inside, she talk say; "Yes Yoruba demons wey involve Ramsey Noah, Jim lyke, AY, Falz de bad guy and plenty of them..."
Onto her las las words before she finally sign out go enter her limousine waka go continue her correct hustle, she yarn say; "Make dem believe in their dreams, follow
am jeje to where e go help dem be good
Ambassador for our country Naija..."


Make we dey try appreciate our own... E no go cost you anything, just click here πŸ‘‰πŸ½http://ducolomal.com/1qMQπŸ‘ˆπŸ½ skip d add and allow God make Him do d rest...

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land