Tuesday, January 15, 2019


Man Shocked To See 13-Year-Old Boy Drinking Beer At A Nigerian Bar.

Ali Ina...

Wetin dey happen to good home training? Wetin dey happen to moral upbringing? Wetin dey happen to this our generation? All these questions come my mind when I hear this story wey I wan tell una so, so that una sef go fit ask or find answers to the questions…
One Nigerian man wey him name na, @Jumabeeforinstagramtalk say him been dey  shocked to see one 13-year old boy dey drink beer for one bar inside Benue state. Him talk say,  the 13-year-old boy, been buy 4 bottles of beer and him finish everything… Chai! Na so him siddon there with so much confidence ooo and the boy even talk say, him don dey come the bar with him uncle, since him been dey  11 years. This na the kind thing wey dey make one Nigerian Actor wey him name na Chiwetalu Agu to shout, akakuluomaokwakwakeluebubekpamkpam! Chai! Make una hear wetin Jumabee write…
''So i been dey one meeting with friends for inside one bar for Benue and dis young boy just bounce enter with so much confidence, con siddon, order for one bottle of beer...Uwuu! As an African man wey I be, e been dey difficult for me, make I just turn eye like say the thing no concine me, because I ask myself say, what if the boy na my small brother??  Na so I con go ask am how many years him be, this boy just smile come ask me, brother why you ask? I come tell am say, because you look too young to dey here. The boy con say, i be 13years old but I don dey come here with my uncle since I been dey 11...
Inside the shock wey I dey, na so i ask again, how you get the money to spend, come buy beer… Na there the boy face con dey change like say, e be like say I don dey ask too much questions... So I just waka go back to my sit con dey take style to video the boy… Na so the boy order four more bottles, con dey swing him legs for chair, dey watch match as him dey drain all the drink with one bottle of coke… Now, fear don dey catch me for this generation ooo, becoz we no dey pay attention to our children again...Parents abeg, make una dey put eye ontop una pikins dem, especially the kind of friends wey dem dey keep and the things wey you sef, dey do for dia presence... For the youths, make our love for money no make us ignore our morals.''


No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land