Tuesday, January 15, 2019


Serious Embarrassment! Abuja Youth Corper Ordered By NYSC CoordinatorTo Kneel Down In Public.

Ali Ina... 

Oyibo talk say Respect is reciprocal… Meaning say if you respect me, me sef go respect you… E be like say na the opposite of wetin happen for Abuja, when one corp member of the National Youth Service Corps(NYSC) been get the most embarrassing moment of him life, as dem order am say make him kneel down for public… Chai! Na so the bobo take shame kneel down as him no fit do any other thing because the order come from above…
We hear say, na the NYSC state coordinator tell am say make him kneel down, sake of say him try to leave, during the address wey him been dey give corps members…
We never know the name of the corp member sha, but for the video wey don dey trend for social media now, na so the corp member kneel down for public as other corp members just dey look am, dey wonder the kind embarrassment wey him dey go through… This thing wey dey sad and embarrassing don make people dey talk about am, as some people dey say, why dem go do this kind  thing wey be inhumane treatment for any graduate… Say, even if dem go punish the corp member, na only to kneel down dey available? Another person say, so President fit tell Minister make him Kneel down for public because him wan commot as him dey talk? I no understand… Toh!  Anyhow wey you see am, you dey entitled to your own opinion…

No comments:

Post a Comment

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land