Friday, October 4, 2019

Welcome Back!!!πŸ€—

ALI INA
Make Una no vex with me abeg! I take God beg Una...πŸ€— I know say we don miss the frequent dramas wey don bin dey go on, around and within but make Una cool Una minds, coz we don come back and this time around na better gist wey go sweet Una belle na im we go dey carry give Una from now... The kind gists wey go touch promotional biographies, gbedu gists and gbege gists... Lol!😜(So if you go like make we take style promote your biography or your gbedu + if you get gbege gist join am, you fit reach me for whatsapp ontop 08175761624/08060959221... Make we yarn from there for pidgin styley)
E be like say na dis point I go like to say una welcome back to this page as you no go regret say you dey part of dis family tree... Make Una no forget say I no go fit dey everywhere or know everything, so make Una helep me put ear and eyes for ground so that gbege or gbedu gist no go just pass all of us like dat...
ALI INA

I still remain the tallest man with the shortest name, the man wey im name no resemble edokido, e no even resemble ikwokrikwo... My name na Ali Ina!

1 comment:

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land