Thursday, February 6, 2020

9 Nigerian Celebrities Wey Marry Their Spouse With Big Age Difference






When e concine heart matter, d kind things wey dey happen ehn, mouth no fit explain am ooo!
Just Like oyibo dey always talk say, age is just a number(age na just number), wetin dey important na love, and these Nigerian celebrities bin find love for some kind ageless places as dem no take panadol for another person headache sake of say the gap for ontop their age wide well well... 
Toh as we waka sotay e no do us, na so we carry come give una, 9 Nigerian celebrity couples wey choose to love each other for who dem be, as dem no mind about the age differences wey dey between them.
1.) Regina Daniels and Ned Nwoko
Regina Daniels and Ned Nwoko
On Sunday, May 26, 2019, Prince Ned Nwoko and Regina Daniels bin do their traditional wedding inside Aniocha local government area, Delta State. Nigerians and fans dem, don criticize 20-year-old Regina well well ontop her marriage to the 59-year-old billionaire, but dat wan no stop her to publicise their official portraits as husband and wife ontop social media as she dey always take style profess her undying love for am...

2.) Lola And Peter Okoye
Lola And Peter Okoye
Peter Okoye aka Mr P and Lola Omotayo na one kind better couple despite the age difference. We hear say, Peter wife, Lola, take 6 years pass am.πŸ€” Dem born Peter and him twin brother Paul on the 18th of November 1981. Lola and Peter bin date for seven years before dem finally engage, con settle down inside marriage. Peter and Lola bin tie the knot as oyibo dey talk am, for 2013 and true true their wedding shake table among celebrity weddings for Nigeria.

3.) Deola And Darey Art Alade
Deola And Darey Art Alade
R&B star and him serial entrepreneur wife, Darey and Deola Art Alade bin marry for February 2007 and Papa God don bless dem with two lovely children. Dem don dey married for like 12 years now. Darey take eight years young pass him wife, Deola.

4.) Omotola and Captain Ekeinde
Omotola and Captain Ekeinde
Nollywood star Actress Omotola Ekeinde and her beau, wey be Capt. Matthew Ekeinde na one kind happy couple wey dey send betta positive vibes. Na when she bin dey 18-year-old, Omotola talk yes for her husband on the 23rd of March 1996. Now dem don dey married for 23 years and Papa God bless dem with 4 children, even though say dem get 10-year age difference between dem.
 
5.) Kaffy And Joseph Ameh
Kaffy And Joseph Ameh
Celebrity dancer, Kafayat Oluwatoyin Shafau and live band drummer, Joseph Adakole Ameh bin marry inside Lagos on June 2, 2012. Papa God don bless dem with two lovely children, Eliana Ameh, their daughter and Sean Ameh, their son. Kaffy take eight years old pass Pappy J as dem dey popularly call am but dem dey happy together...πŸ€—

6.) Joke Silva and Olu Jacobs
Joke Silva and Olu Jacobs
Internationally-acclaimed Nigerian Actor and film executive, Olu Jacobs dey married to veteran Actress Joke Silva. This Nollywood power couple don dey married since 1989 when Olu Jacobs be 39 years and Joke Silva be 20 years old. The couple bin meet for 1981 for the National Theatre, Lagos, during the 21st Independence anniversary. Today dem be proud parents and grandparents.

7.) Sade and Rasaq Okoya
Sade and Rasaq Okoya
42-year-old Sade Okoya dey married to 79-year-old Nigerian industrialist and owner of Eleganza group of companies, Chief Rasaq Akanni Okoya. The couple don dey married for over 20 years and dem get four beautiful children together.

8.) Susan Hart and Sunny Kuku
Susan Hart and Sunny Kuku
Ex-beauty Queen and winner of the 1994 edition of the Most Beautiful Girl in Nigeria beauty pageant, wey be Susan Hart dey married to Doctor Olorogun Sunny Kuku, wey be d renowned medical director wey also co-own d popular Eko Hospital, many years back. Susan wey believe say age no be barrier inside their marriage, talk say her husband humility and humbleness na im make dem be best friends. Dem don dey married for some years now and dem still dey enjoy am like yesterday. They even get one son together.

9.) Faith Ikuku and Micheal Ikuku
Faith Ikuku and Micheal Ikuku
31-year-old Chief Mrs Faith Ikuku na d wife of 63-year-old billionaire businessman, Chief Michael Ikuku.

Toh you wey dey see am like say age na barrier, wetin be your excuse? Make we yarn...

2 comments:

  1. I don learn a lot here... Very expository...

    Always go for who loves you... Na wetin dey important be dat...

    ReplyDelete
  2. This is really a good insight on this topic. People need to see this. Age is a number. Maturity counts

    ReplyDelete

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land