Friday, January 17, 2020

MARY CHUKWU: "I go like open pipo eye with my movies. AIl my movies dey carry strong message. So I go like achieve positive change..."


Make una no forget to encourage our correct hustle by just to click here πŸ‘‰πŸ½http://ellevolaw.com/31wKπŸ‘ˆπŸ½...


Nollywood na very lucrative industry wey don produce talents wey boku full Naija... And as e be so, na im be one of the largest employer of labour for dis dispensation wey we dey so, especially if you see d recent money wey d industry dey generate from im daily execution of d business wey be to dey make films... But dat wan no be d koko! Inside Nollywood, we get talents and inside these boku talents, we still get ogbonge talents.... Our work dey very simple for dis blog, we dey celebrate talents for every corner of endeavors for our ogbodo Naija... Na dis wan make us waka con jam dis fine babe wey don already dey make wave ontop her hustle inside Nollywood sotay she recently bag African Giant Strides Better Award of Actor of the year 2019... Omo! No be small thing be dat oo! E mean say dis babe don dey around for some time, incase you dey wonder.... But no wonder too much because our waka don land for her domot... Make we allow her use her mouth take chop d onions by herself so dat we go know her betta;

"My name na Mary Chukwu..." Chai! See sweet name! Na d name make us con sharperly ask her na which state for Naija dem born her? She no waste Time as she talk say; "Dem born me for Enugu state
for 11 November 1986..." πŸ€”No wonder she fine d way wey she fine... Dis wan na proof say Enugu babes dey fresh fine like Mary Chukwu ooo! 😘Lol! 😁Anyway as we continue, onto her educational background, she talk say;

"I bin attend Pilot Science
Primary School. I con go 3 Secondary
Schools... Then i do Diploma in Mass
Communication Con finish every-every,
for University of Abuja where I bag
B.A English Literature..." Wow! No be small levels oo! If you think say Nollywood na beans, people like Mary Chukwu go reset your brain with their portfolio, because education na very important aspect wey we don notice for most of d stars wey dey for Nollywood today... As we take style go front, na so we con ask her say, make she tell us wetin she dey do now, so dat people wey no know her, go know am. She yarn say;
 "I be passionate Actor, And I still
dey do businesses for side..." Correct! I go salute dis Enugu babe because she don take style clear d air for people wey think say only acting for Nollywood fit carry you far... E fit carry you reach one level but you gats do business for side to maintain dat level and still go up-up again... Na here we con match fire small as we ask her say make she take style gist us how she take become Actor sotay she reach d level wey she don reach so... Unto dis wan, na im she yarn say;
 "I become Actor because I like to
act. So I call am passion. But now
na the business aspect of the
industry I dey look because we need to pay bills..." Chai! Mary Chukwu talk dey give me Joy because no be only say she be babe with Talent but na babe with sense and tru-tru dis kind sense no be sense wey person fit just get from school, but from experience too... Anyway, make I no talk too much as we still get plenty things to discover from Mary Chukwu... Unto wetin she go like achieve with wetin she dey do, she no too think am as she talk say;
  "I go like open pipo eye with my movies. AIl my movies dey carry
strong message. So I go like achieve
positive change..." I go reserve my comment before person say I don dey too talk too much, but make I continue to dey trip just to hear as Mary Chukwu dey intelligently talk her mind for pidgin... πŸ€—When we con reach d time to ask her how far she don waka for dis her career, she talk say;

"Omo! I don waka sha. At some point I nearly give up. Even now sef the money never dey show compared to the level of work. But we dey grow..." I believe dis babe die... And na tru talk she don yarn so... D level of work no dey agree with d level of pay and dis na something wey d industry giants suppose chook eye and mouth on top... Anyway make I maintain my lane o! 🀫As we take style push go front again, na so we ask her say, na who be d person for d industry wey she dey look up to like Mentor? She no think am twice as she sharperly talk say;

"Nse Ikpe Etim I like that woman..." If you know dis woman, then you go understand d strength of talent wey Mary Chukwu carry... But make we fire on! Na here we con ask her say how long she feel say she go dey pursue dis her career path? She simply talk say;

"Well , now na for only acting career. But I go diversify into Producing and Directing... Dem no dey retire na, So na for life..." Hmmm when you hear Mary Chukwu dey talk, dem no need to tell you say dis wan na Babe wey know who she be, wetin she want and where she dey go... My respect for dis babe don increase level I no go lie... As time don dey give us signal to take style begin to dey match break, na so we con ask her say which kind thing she go like leave as legacy, wey go make people take style dey remember her? She talk say;
"I Just wan be my original self and i believe say e dey enough because I know say I be better person..." Honestly babe, you no need to talk am, you don already show am say you be betta person and we dey your back on behalf of your fans dem... 🀬Oops! Hope say I never talk too much o! 🀭Lol! Na here we con tell her say make she tell us wether some movie projects dey wey she do by herself or she joinbody do because we know say plenty people fit don watch her movies and no know say na she we dey yarn with today... She yarn say;
  "Dem plenty o. I don do Broken, where dem nominate me for Best Supporting Actress. The recent projects wey I don do include; My Kids and I. A Loving Heart. Stay With Me. Scream. The Rock and A Hard Place. Love Again. Etc..." OK Una don hear am! Look for dem and take style ask google and trust me, you no go miss road... Before she majestically waka like Royal Majesty wey we believe say she be, go enter her limousine take style go her next movie location, go continue her career hustle, na so we beg her, make she use her church mind advice those wey just dey start. She talk say;

"My advice to dem na to stay true to their passion and dreams for dis life..." Simple! As she talk am, na so e be o! Las-Las, when we ask her if anything again dey wey she go like talk about, she yarn say; "I don talk everything o. But make I add say. We all go meet for top. Bcos dis sky get space to contain us all..." Hmm see wisdom from babe wey sabi! OK my work here don finish but make we no forget say we fit join d discussion as we get chance to talk our mind under here too, for d comment section and incase we wan know more about Mary Chukwu, you fit follow her on top her social media handles;

IG: @officialmarychukwu
OR
Twitter: @preetymc1
Make una no forget to encourage our correct hustle by just to click here πŸ‘‰πŸ½http://ellevolaw.com/31wKπŸ‘ˆπŸ½...

2 comments:

  1. Chai, diz actor abi na actress as oyinbo dey call am don do well well for diz film mata o. I don work wit am and she sabi d tin like say dem born am wit am. She come humble join, come get plenty sabi for English and den uku wit her fine face come complete d over sabi. God go bless your hustle. Him go give u more jobs and ones we big pass these ones. Amen. I be your number one fan Mary Chukwu

    ReplyDelete
  2. Oga Wengs no be lie and I believe you well well... God go bless Una for d good work wey una dey do... And for Mary Chukwu, I never get money, but make I be your number 1 fan for now... Continue dey shine!!!

    ReplyDelete

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land