Friday, January 17, 2020

MC GODAP: "I be Movie Producer, Film Maker, Cooperate Mc, Event planner, Media Practitioner and Entertainment Guru..."

Make una no forget to click here to encourage our correct hustle ooo! Na new year be dis, click here to encourage us ๐Ÿ‘‰๐Ÿฝhttp://ellevolaw.com/2yHn๐Ÿ‘ˆ๐Ÿฝ

As we still dey cruise for inside year 2020, we never forget say our primary and secondary aim na to always make sure say talents dey appreciated, no matter how small dem dey... Nobody know wetin one word of encouragement or one act of encouragement fit do for person wey dey hustle and never see breakthrough or d breakthrough dey come small small but as far say God dey, we believe say consistency and hard work dey bring betta breakthrough one day... Anyway as we don talk reach dis level, our waka don carry us reach d domot of one young man wey dey try well well on top him hustle sotay him dey press on, even when situations dey tell am say make him give up and na d encouraging thing be dat, wey make us stop our cruise so dat we go chat with am, for Una... Oya make we meet our guest;

"My name na Mc Godap (Godwin Dapon) and na from Niger state I come from... Dem born me for 11 October..." ๐Ÿคฆ๐ŸฝChai! I know no why una no dey like to make us know wether you dey young or you don old... Lol!๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚ But i sure say all na for reasons wey dey best known to am sha... As him continue for on top him educational background, him talk say;
"I bin attend
Ola-olu int children school mararaba aso.
New Generation int  Academy. Aso-A
Precious Gift int school mararaba
All of dem for Nasarawa state... I bin also attend Akwa ibom State Polytechnic.  Where I bin get ND in Business studies. I con go Fed. Polytechnic Nas. State. Where I bin get Diploma in crime management
Iris computer center. Diploma in computer..." ๐Ÿ˜ฎBros! You go schools oooo! Lol!๐Ÿคฃ๐Ÿ˜ Anyway na good thing and good example him dey show so o! Dis wan mean say education dey necessary even if no be d yardstick to take measure success... Okay, onto who him be for now, him no waste time to talk say;
  "I be Movie Producer, Film Maker, Cooperate Mc, Event planner,  Media Practitioner and Entertainment Guru..." Chai! Dis young man dey surprise me oo! Ahn ahn! Only you!๐Ÿ˜ฏ... Anyway make I comment my reserve... As we take style go front small because of time, na so we con ask am say how long him don dey do dis plenty hustle? Him talk say;

"For years I don dey waka for this career, and e no easy, and I still dey push but Since when i bin small pikin, I don love dis acting profession and na wetin drive my passion wey I con develope into film making, entertainment and media, and recently movie producer..." Omo! No be small levels ooo wey Mc Godap dey display so! Dis wan mean say him dey utilize d brain wey Papa God give am well well... Okay, na here we con ask am say wetin him go like achieve with wetin him dey do so far? Him yarn say;

"I go like achieve great success, and to take style contribute my best on top the industry and still kukuma rise go wetin oyibo dey call the zenith for art, media and entertainment world..." Chai! Mc Godap don finish work for here with grammar oo! But we dey pray make Papa God hear dis prayer so dat all of us go celebrate soon... Toh, onto who con be person wey him dey look up to or him person wey him fit say na him mentor for d industry, him no waste time to tell us say na;
  "Victor Decka..." So, As we don dey prepare to match break on top dis cruise, na so we ask am say how long him feel say him go wan dey do dis hustle, na so him no think twice to yarn say; "For my lifetime" Hmm! See na dis kind thing oyibo dey call 'resolute'... If you no understand ask Google๐Ÿ˜›๐Ÿ˜œ๐Ÿ˜›๐Ÿ˜œ... What of d kind legacy wey Mc Godap go like leave, wey go make people dey remember am for dis lifetime, him talk say;

"I go like make my legacy be "Togetherness " to achieve success with other people dem..." Correct! Him don take style preach cooperate and collective responsibility oo! Anyway as we con take style ask am say, shey projects dey wey you don work on or you dey join body with others dey work on, wey you go like make we know? Him happily talk say;
  "Yes ooo, dem plenty but dem no plenty sha, Unfailing vow, Imagine If, Ghetto Hero, End time Assignment etc..." Okay Una don hear am from Mc Godap mouth, make una make sure say una look for dem ooo! Toh on top him las-las words to people wey dey start and those wey dey hustle like am, him yarn specially say; "I go appeal to dem say make dem try dey patient and steadfast to your dreams and career and also dey loyal to those ones wey dey ahead of you(wey oyibo dey call Mentors)... I go also like to thank the first pidgin blog for this opportunity, I go also like to talk say make more awareness dey so that e go expose more young people to this opportunity, wey go help make their career better..." Make we no forget say we fit contribute to encourage Mc Godap on top dis him hustle under the comment section here so dat we go take style dey celebrate our own for the small small efforts wey dem dey make...
Make una no forget to click here to encourage our correct hustle ooo! Na new year be dis, click here to encourage us ๐Ÿ‘‰๐Ÿฝhttp://ellevolaw.com/2yHn๐Ÿ‘ˆ๐Ÿฝ

1 comment:

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land