Thursday, February 13, 2020

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!



All staff, students and pikins dem of Royalland Academy dey use dis opportunity take style dey invite our parents/guardians and the GENERAL OGBONGE PUBLIC come the maiden edition of her SOCIAL WEEK!!!

The citadel of learning dey carry extra-curricula activities go the next level. Make you carry your two legs Come learn with us beyond the four walls of the classroom. Our schedule of days and activities na;

➡MONDAY: Personal hygiene, fruit day, entrepreneurship day, movie day.๐Ÿค—
➡TUESDAY: Cultural day, literary day, drama.๐Ÿค—๐Ÿค—
➡WEDNESDAY: Sex education, intra-school sport.๐Ÿค—๐Ÿค—๐Ÿค—
➡THURSDAY: Career day, debate, Coronation๐Ÿค—๐Ÿค—๐Ÿค—๐Ÿค—
➡FRIDAY: Excursion๐Ÿค—๐Ÿค—๐Ÿค—๐Ÿค—๐Ÿค—

Special feature: CORONATION OF KING & QUEEN OF ROYALLAND ๐Ÿคด ๐Ÿ‘ธ 

Time: 8am daily.
Venue: Secondary section, Royalland Academy.

No school fit do am pass Royalland Academy!

Oya tell your friends, neighbors, family and enemies too!๐Ÿ˜๐Ÿ˜๐Ÿ˜

Wednesday, February 12, 2020

Tanda To Standout With JCMI Youths Valentine Special...


Jos Christian Missions International(JCMI), na Apostolic Community of believers wey dey totally committed to the Lordship of Jesus Christ and to impact the world and the nations wey dey ontop earth with wetin oyibo dey call doctrine wey be "Christ in us the hope of glory."
As JCMI don reach dis level so, inside year 2020 na so the youths don come together to take style put betta programme wey go further spread the love of Christ for we country...
Come 14th February wey be Valentine Day, JCMI youths go tanda to standout with Valentine Programme wey get THEME: WHEN LOVE OVERFLOWS...(1 Thessalonians 3:12)... The program go get plenty ogbonge side attractions like; Drama, Dance, Karaoke, Burn Fire, Poetry, Live Streaming and plenty plenty things wey my mouth no fit talk... 
TIME NA: RED CARPET 3PM
                   MAIN EVENT 4PM
VENUE NA: JCMI RECREATION CENTRE

Omo! If na me be you, I go clear my schedule so dat me sef go tanda to standout with the event wey go happen for dat day inside Jos, Plateau State! If you wan get more informate, make you check the flier well well... Any other informate, drop your comment under here and we go reach you... God go bless you nyafu nyafu as you come!!!

Thursday, February 6, 2020

9 Nigerian Celebrities Wey Marry Their Spouse With Big Age Difference






When e concine heart matter, d kind things wey dey happen ehn, mouth no fit explain am ooo!
Just Like oyibo dey always talk say, age is just a number(age na just number), wetin dey important na love, and these Nigerian celebrities bin find love for some kind ageless places as dem no take panadol for another person headache sake of say the gap for ontop their age wide well well... 
Toh as we waka sotay e no do us, na so we carry come give una, 9 Nigerian celebrity couples wey choose to love each other for who dem be, as dem no mind about the age differences wey dey between them.
1.) Regina Daniels and Ned Nwoko
Regina Daniels and Ned Nwoko
On Sunday, May 26, 2019, Prince Ned Nwoko and Regina Daniels bin do their traditional wedding inside Aniocha local government area, Delta State. Nigerians and fans dem, don criticize 20-year-old Regina well well ontop her marriage to the 59-year-old billionaire, but dat wan no stop her to publicise their official portraits as husband and wife ontop social media as she dey always take style profess her undying love for am...

2.) Lola And Peter Okoye
Lola And Peter Okoye
Peter Okoye aka Mr P and Lola Omotayo na one kind better couple despite the age difference. We hear say, Peter wife, Lola, take 6 years pass am.๐Ÿค” Dem born Peter and him twin brother Paul on the 18th of November 1981. Lola and Peter bin date for seven years before dem finally engage, con settle down inside marriage. Peter and Lola bin tie the knot as oyibo dey talk am, for 2013 and true true their wedding shake table among celebrity weddings for Nigeria.

3.) Deola And Darey Art Alade
Deola And Darey Art Alade
R&B star and him serial entrepreneur wife, Darey and Deola Art Alade bin marry for February 2007 and Papa God don bless dem with two lovely children. Dem don dey married for like 12 years now. Darey take eight years young pass him wife, Deola.

4.) Omotola and Captain Ekeinde
Omotola and Captain Ekeinde
Nollywood star Actress Omotola Ekeinde and her beau, wey be Capt. Matthew Ekeinde na one kind happy couple wey dey send betta positive vibes. Na when she bin dey 18-year-old, Omotola talk yes for her husband on the 23rd of March 1996. Now dem don dey married for 23 years and Papa God bless dem with 4 children, even though say dem get 10-year age difference between dem.
 
5.) Kaffy And Joseph Ameh
Kaffy And Joseph Ameh
Celebrity dancer, Kafayat Oluwatoyin Shafau and live band drummer, Joseph Adakole Ameh bin marry inside Lagos on June 2, 2012. Papa God don bless dem with two lovely children, Eliana Ameh, their daughter and Sean Ameh, their son. Kaffy take eight years old pass Pappy J as dem dey popularly call am but dem dey happy together...๐Ÿค—

6.) Joke Silva and Olu Jacobs
Joke Silva and Olu Jacobs
Internationally-acclaimed Nigerian Actor and film executive, Olu Jacobs dey married to veteran Actress Joke Silva. This Nollywood power couple don dey married since 1989 when Olu Jacobs be 39 years and Joke Silva be 20 years old. The couple bin meet for 1981 for the National Theatre, Lagos, during the 21st Independence anniversary. Today dem be proud parents and grandparents.

7.) Sade and Rasaq Okoya
Sade and Rasaq Okoya
42-year-old Sade Okoya dey married to 79-year-old Nigerian industrialist and owner of Eleganza group of companies, Chief Rasaq Akanni Okoya. The couple don dey married for over 20 years and dem get four beautiful children together.

8.) Susan Hart and Sunny Kuku
Susan Hart and Sunny Kuku
Ex-beauty Queen and winner of the 1994 edition of the Most Beautiful Girl in Nigeria beauty pageant, wey be Susan Hart dey married to Doctor Olorogun Sunny Kuku, wey be d renowned medical director wey also co-own d popular Eko Hospital, many years back. Susan wey believe say age no be barrier inside their marriage, talk say her husband humility and humbleness na im make dem be best friends. Dem don dey married for some years now and dem still dey enjoy am like yesterday. They even get one son together.

9.) Faith Ikuku and Micheal Ikuku
Faith Ikuku and Micheal Ikuku
31-year-old Chief Mrs Faith Ikuku na d wife of 63-year-old billionaire businessman, Chief Michael Ikuku.

Toh you wey dey see am like say age na barrier, wetin be your excuse? Make we yarn...

Monday, February 3, 2020

Living Faith Kaduna: Police dey investigate man wey carry 'bomb' enta Winners


Police for Kaduna State say dem dey investigate one Nathaniel Samuel wey dem arrest with dangerous suspected Improvised Explosive Device (IED) for one Church for Sabon Tasha area of Chikun local government area of di state.

Di Command Public Relations Officer, DSP Yakubu Sabo, tell BBC say dem arrest di suspect for di Living Faith Church during Sunday Church service with bag wey im take carry di locally made 'bomb'.
http://scapognel.com/JnA
Oga Sabo say di suspect dey di Command Criminal Investigation Department for further interrogation on wetin im dey find with di IED inside church bag.
Di incident dey come on di day wey di General overseer of Redeemed church Pastor Adeboye, lead im church members for prayer waka.
http://scapognel.com/JnA
Di Christian Association of Nigeria (CAN) bin declare di prayer waka to address di kill-kill across di kontri .
Last month Islamic militant gbab and kill di chairman of di Christian Association of Nigeria (CAN) for Michika, Adamawa State north east of di kontri.
http://scapognel.com/JnA

Monday, January 27, 2020

Kobe Bryant: Wetin you need to know about di Basketball legend




Click here to take style encourage our hustle ... . http://homoluath.com/PYG RIP Kobe Bryant....

Image copyrigh

All over di world, pipo dey pay dia respect to di ogbonge basketball player Kobe Bryant wey die on Sunday, January 26, 2020 at di age of 41.
Kobe, im 13 years old daughter Gianna, dey among nine pipo wey die inside one helicopter crash for di city of Calabasa, California.

Former America President Barack Obama call am "legend on di court", while ogbonge retired basketball player, Kareem Abdul-Jabbar say "many pipo go remember Kobe as di ogbonge athlete wey inspire a whole generation of basketball players."

Who be Kobe Byant?

Bryant na di pikin of former NBA player Joe Bryant. Him attend Lower Merion High School for Pennsylvania, wia dem recognize am as di top high-school basketball player for di kontri.
Dem born Bryant for Philadelphia, as di youngest of three children and only son of di former NBA player Joe Bryant and Pamela Cox Bryant. Him be also di maternal nephew of basketball player John "Chubby" Cox.
Bryant 41, na five time NBA champion wey spend im entire 20-year career with di Los Angeles Lakers
E enter di NBA directly from high school and win five NBA championships.
Him bin retire for April 2016.
Click here to take style encourage our hustle ... . http://homoluath.com/PYG RIP Kobe Bryant....

Friday, January 17, 2020

MARY CHUKWU: "I go like open pipo eye with my movies. AIl my movies dey carry strong message. So I go like achieve positive change..."


Make una no forget to encourage our correct hustle by just to click here ๐Ÿ‘‰๐Ÿฝhttp://ellevolaw.com/31wK๐Ÿ‘ˆ๐Ÿฝ...


Nollywood na very lucrative industry wey don produce talents wey boku full Naija... And as e be so, na im be one of the largest employer of labour for dis dispensation wey we dey so, especially if you see d recent money wey d industry dey generate from im daily execution of d business wey be to dey make films... But dat wan no be d koko! Inside Nollywood, we get talents and inside these boku talents, we still get ogbonge talents.... Our work dey very simple for dis blog, we dey celebrate talents for every corner of endeavors for our ogbodo Naija... Na dis wan make us waka con jam dis fine babe wey don already dey make wave ontop her hustle inside Nollywood sotay she recently bag African Giant Strides Better Award of Actor of the year 2019... Omo! No be small thing be dat oo! E mean say dis babe don dey around for some time, incase you dey wonder.... But no wonder too much because our waka don land for her domot... Make we allow her use her mouth take chop d onions by herself so dat we go know her betta;

"My name na Mary Chukwu..." Chai! See sweet name! Na d name make us con sharperly ask her na which state for Naija dem born her? She no waste Time as she talk say; "Dem born me for Enugu state
for 11 November 1986..." ๐Ÿค”No wonder she fine d way wey she fine... Dis wan na proof say Enugu babes dey fresh fine like Mary Chukwu ooo! ๐Ÿ˜˜Lol! ๐Ÿ˜Anyway as we continue, onto her educational background, she talk say;

"I bin attend Pilot Science
Primary School. I con go 3 Secondary
Schools... Then i do Diploma in Mass
Communication Con finish every-every,
for University of Abuja where I bag
B.A English Literature..." Wow! No be small levels oo! If you think say Nollywood na beans, people like Mary Chukwu go reset your brain with their portfolio, because education na very important aspect wey we don notice for most of d stars wey dey for Nollywood today... As we take style go front, na so we con ask her say, make she tell us wetin she dey do now, so dat people wey no know her, go know am. She yarn say;
 "I be passionate Actor, And I still
dey do businesses for side..." Correct! I go salute dis Enugu babe because she don take style clear d air for people wey think say only acting for Nollywood fit carry you far... E fit carry you reach one level but you gats do business for side to maintain dat level and still go up-up again... Na here we con match fire small as we ask her say make she take style gist us how she take become Actor sotay she reach d level wey she don reach so... Unto dis wan, na im she yarn say;
 "I become Actor because I like to
act. So I call am passion. But now
na the business aspect of the
industry I dey look because we need to pay bills..." Chai! Mary Chukwu talk dey give me Joy because no be only say she be babe with Talent but na babe with sense and tru-tru dis kind sense no be sense wey person fit just get from school, but from experience too... Anyway, make I no talk too much as we still get plenty things to discover from Mary Chukwu... Unto wetin she go like achieve with wetin she dey do, she no too think am as she talk say;
  "I go like open pipo eye with my movies. AIl my movies dey carry
strong message. So I go like achieve
positive change..." I go reserve my comment before person say I don dey too talk too much, but make I continue to dey trip just to hear as Mary Chukwu dey intelligently talk her mind for pidgin... ๐Ÿค—When we con reach d time to ask her how far she don waka for dis her career, she talk say;

"Omo! I don waka sha. At some point I nearly give up. Even now sef the money never dey show compared to the level of work. But we dey grow..." I believe dis babe die... And na tru talk she don yarn so... D level of work no dey agree with d level of pay and dis na something wey d industry giants suppose chook eye and mouth on top... Anyway make I maintain my lane o! ๐ŸคซAs we take style push go front again, na so we ask her say, na who be d person for d industry wey she dey look up to like Mentor? She no think am twice as she sharperly talk say;

"Nse Ikpe Etim I like that woman..." If you know dis woman, then you go understand d strength of talent wey Mary Chukwu carry... But make we fire on! Na here we con ask her say how long she feel say she go dey pursue dis her career path? She simply talk say;

"Well , now na for only acting career. But I go diversify into Producing and Directing... Dem no dey retire na, So na for life..." Hmmm when you hear Mary Chukwu dey talk, dem no need to tell you say dis wan na Babe wey know who she be, wetin she want and where she dey go... My respect for dis babe don increase level I no go lie... As time don dey give us signal to take style begin to dey match break, na so we con ask her say which kind thing she go like leave as legacy, wey go make people take style dey remember her? She talk say;
"I Just wan be my original self and i believe say e dey enough because I know say I be better person..." Honestly babe, you no need to talk am, you don already show am say you be betta person and we dey your back on behalf of your fans dem... ๐ŸคฌOops! Hope say I never talk too much o! ๐ŸคญLol! Na here we con tell her say make she tell us wether some movie projects dey wey she do by herself or she joinbody do because we know say plenty people fit don watch her movies and no know say na she we dey yarn with today... She yarn say;
  "Dem plenty o. I don do Broken, where dem nominate me for Best Supporting Actress. The recent projects wey I don do include; My Kids and I. A Loving Heart. Stay With Me. Scream. The Rock and A Hard Place. Love Again. Etc..." OK Una don hear am! Look for dem and take style ask google and trust me, you no go miss road... Before she majestically waka like Royal Majesty wey we believe say she be, go enter her limousine take style go her next movie location, go continue her career hustle, na so we beg her, make she use her church mind advice those wey just dey start. She talk say;

"My advice to dem na to stay true to their passion and dreams for dis life..." Simple! As she talk am, na so e be o! Las-Las, when we ask her if anything again dey wey she go like talk about, she yarn say; "I don talk everything o. But make I add say. We all go meet for top. Bcos dis sky get space to contain us all..." Hmm see wisdom from babe wey sabi! OK my work here don finish but make we no forget say we fit join d discussion as we get chance to talk our mind under here too, for d comment section and incase we wan know more about Mary Chukwu, you fit follow her on top her social media handles;

IG: @officialmarychukwu
OR
Twitter: @preetymc1
Make una no forget to encourage our correct hustle by just to click here ๐Ÿ‘‰๐Ÿฝhttp://ellevolaw.com/31wK๐Ÿ‘ˆ๐Ÿฝ...

MC GODAP: "I be Movie Producer, Film Maker, Cooperate Mc, Event planner, Media Practitioner and Entertainment Guru..."

Make una no forget to click here to encourage our correct hustle ooo! Na new year be dis, click here to encourage us ๐Ÿ‘‰๐Ÿฝhttp://ellevolaw.com/2yHn๐Ÿ‘ˆ๐Ÿฝ

As we still dey cruise for inside year 2020, we never forget say our primary and secondary aim na to always make sure say talents dey appreciated, no matter how small dem dey... Nobody know wetin one word of encouragement or one act of encouragement fit do for person wey dey hustle and never see breakthrough or d breakthrough dey come small small but as far say God dey, we believe say consistency and hard work dey bring betta breakthrough one day... Anyway as we don talk reach dis level, our waka don carry us reach d domot of one young man wey dey try well well on top him hustle sotay him dey press on, even when situations dey tell am say make him give up and na d encouraging thing be dat, wey make us stop our cruise so dat we go chat with am, for Una... Oya make we meet our guest;

"My name na Mc Godap (Godwin Dapon) and na from Niger state I come from... Dem born me for 11 October..." ๐Ÿคฆ๐ŸฝChai! I know no why una no dey like to make us know wether you dey young or you don old... Lol!๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚ But i sure say all na for reasons wey dey best known to am sha... As him continue for on top him educational background, him talk say;
"I bin attend
Ola-olu int children school mararaba aso.
New Generation int  Academy. Aso-A
Precious Gift int school mararaba
All of dem for Nasarawa state... I bin also attend Akwa ibom State Polytechnic.  Where I bin get ND in Business studies. I con go Fed. Polytechnic Nas. State. Where I bin get Diploma in crime management
Iris computer center. Diploma in computer..." ๐Ÿ˜ฎBros! You go schools oooo! Lol!๐Ÿคฃ๐Ÿ˜ Anyway na good thing and good example him dey show so o! Dis wan mean say education dey necessary even if no be d yardstick to take measure success... Okay, onto who him be for now, him no waste time to talk say;
  "I be Movie Producer, Film Maker, Cooperate Mc, Event planner,  Media Practitioner and Entertainment Guru..." Chai! Dis young man dey surprise me oo! Ahn ahn! Only you!๐Ÿ˜ฏ... Anyway make I comment my reserve... As we take style go front small because of time, na so we con ask am say how long him don dey do dis plenty hustle? Him talk say;

"For years I don dey waka for this career, and e no easy, and I still dey push but Since when i bin small pikin, I don love dis acting profession and na wetin drive my passion wey I con develope into film making, entertainment and media, and recently movie producer..." Omo! No be small levels ooo wey Mc Godap dey display so! Dis wan mean say him dey utilize d brain wey Papa God give am well well... Okay, na here we con ask am say wetin him go like achieve with wetin him dey do so far? Him yarn say;

"I go like achieve great success, and to take style contribute my best on top the industry and still kukuma rise go wetin oyibo dey call the zenith for art, media and entertainment world..." Chai! Mc Godap don finish work for here with grammar oo! But we dey pray make Papa God hear dis prayer so dat all of us go celebrate soon... Toh, onto who con be person wey him dey look up to or him person wey him fit say na him mentor for d industry, him no waste time to tell us say na;
  "Victor Decka..." So, As we don dey prepare to match break on top dis cruise, na so we ask am say how long him feel say him go wan dey do dis hustle, na so him no think twice to yarn say; "For my lifetime" Hmm! See na dis kind thing oyibo dey call 'resolute'... If you no understand ask Google๐Ÿ˜›๐Ÿ˜œ๐Ÿ˜›๐Ÿ˜œ... What of d kind legacy wey Mc Godap go like leave, wey go make people dey remember am for dis lifetime, him talk say;

"I go like make my legacy be "Togetherness " to achieve success with other people dem..." Correct! Him don take style preach cooperate and collective responsibility oo! Anyway as we con take style ask am say, shey projects dey wey you don work on or you dey join body with others dey work on, wey you go like make we know? Him happily talk say;
  "Yes ooo, dem plenty but dem no plenty sha, Unfailing vow, Imagine If, Ghetto Hero, End time Assignment etc..." Okay Una don hear am from Mc Godap mouth, make una make sure say una look for dem ooo! Toh on top him las-las words to people wey dey start and those wey dey hustle like am, him yarn specially say; "I go appeal to dem say make dem try dey patient and steadfast to your dreams and career and also dey loyal to those ones wey dey ahead of you(wey oyibo dey call Mentors)... I go also like to thank the first pidgin blog for this opportunity, I go also like to talk say make more awareness dey so that e go expose more young people to this opportunity, wey go help make their career better..." Make we no forget say we fit contribute to encourage Mc Godap on top dis him hustle under the comment section here so dat we go take style dey celebrate our own for the small small efforts wey dem dey make...
Make una no forget to click here to encourage our correct hustle ooo! Na new year be dis, click here to encourage us ๐Ÿ‘‰๐Ÿฝhttp://ellevolaw.com/2yHn๐Ÿ‘ˆ๐Ÿฝ

Wednesday, January 8, 2020

TENIOLA DALTONS: "I be student ooo but I also be OAP & Actor..."





Na new year we dey so ooo... Make una try help encourage us so that our hustle go pay... Just click here ๐Ÿ‘‰๐Ÿฝ http://pladollmo.com/1oAA๐Ÿ‘ˆ๐Ÿฝ shikena! You don do your part!!!



D era wey we dey for Naija now, na era wey everybody no matter how old or young, need encouragement so dat dem go still hold their head high on top d legitimate hussle wey dem dey do... Na people wey dey try on top their legitimate hussle na dem we dey always like to waka go meet so dat dem go fit share their stories with us plus their experiences wey go make us appreciate dem well well... Anyway introduction don do, make we meet our guest for today, wey be one young lady wey dey try on top her legitimate hussle...;
  "My name na Adeniran Deborah... Dem born me for Plateau State... But my state of origin name na Oyo state..." As per her educational background, she yarn say; "I do my primary school for first baptist school jos. I con do my secondary school for Ambassador Academy Nassarawa. Now, I dey study Theatre Arts for higher institution..." Wow dis young babe na Thespian wey wan hussle to make name for herself... E dey always good to see young people especially young ladies wey get mind say dem wan hussle so dat society fit recognize say dem dey contribute their own quota ontop nation building... Anyway, as per who she be, she no waste time to let us know say;
  "I be student ooo but I also be OAP & Actor..." For dis age, dis young lady don understand say e dey good to diversify for career pursuit in case of incasity(anyhow wey you understand am, na so e be... Lol!) Where we been notice her na for d Face of Arts Beauty Pageant wey bin hold on 17th November 2019 and she bin do well for her outings even though say she no win, na dat wan con make us ask her how d experience be? She yarn say;

"Yes I dey among the contestants of FABP 2019 and interestingly, na my first time even though say I bin feel neglected..." Ehyaaa e dey happen like dat most times... Anyway sha, when we ask her say wetin she go like to achieve with dis career path wey she dey pursue, she yarn say; "I go like make I become celebrity wey dey do people better..." OK if e be like dis, na how far you wan con go for dis career path? She talk say;
  "I wan go very far for pageant so that I go fit dey do better things for people..." D only thing wey dey dis young babe mind na how she go take dey do betta things for people... We go only pray make God help am achieve so dat she go do d betta things wey she dey always talk about... Na here we con ask her say, she get any mentor, if yes na who him or her be? She no think twice as she talk say;
  "my mentor na Okpe Lawrence and na better person him b..." Toh I hope say Okpe Lawrence dey hear dis wan ooo make him head no swell scatter... Lol! Unto how long she go like pursue dis career, she talk say; "I wan do am for 2 years..." OK so if na d case be dat, which kind legacy you go like leave wey people go take dey remember you? She still continue say;
  "I go like make I leave good character wey people go fit follow..." Make sense sha... As time don dey give us signal to take style match break for dis session, we sharperly ask her wether she don do any project or she join body with others or person to do any project? She talk say; "I never do any project..." All na small small sha... We believe say with time, we go still come here again to celebrate her on top d many many projects wey she don do and wey she dey plan to do as her own contribution to betta we country... Las las she con dey advice newcomers and upcomers say; "I go like make I advice upcoming OAPs make dem focus for wetin dem dey do..." No forget to comment under here to encourage Teniola Daltons and these na her social media handles;
Facebook: Debbi Teniola Daltons
Intagram: Teniola Daltons

Na new year we dey so ooo... Make una try help encourage us so that our hustle go pay... Just click here ๐Ÿ‘‰๐Ÿฝ http://pladollmo.com/1oAA๐Ÿ‘ˆ๐Ÿฝ shikena! You don do your part!!!

ROYALLAND ACADEMY SOCIAL WEEK!!!

New Gbege Wey Just Land